Imo State House of Assembly witness gunshots after suspension of lawmakers - See wetin we know

Wia dis foto come from, Imo State
Lawmakers inside di Imo State House of Assembly hear plenty gunshots after di Speaker announce suspension for former house leader Uche Ogbuagu, and five members.
One video wey dey circulate show lawmakers from di eastern state of Nigeria inside building, as gunshots begin fire nearby. Dis one cause small commotion among di lawmakers.
Earlier, Speaker of di House, Hon. Paul Emeziem bin don announce di suspension of six members ontop dia "unparliamentary conduct".

Wia dis foto come from, Imo State
Di suspended members be: Uche Ogbuagu (Ikeduru LGA), Barrister Anyadike (Ezinihitte LGA), Ezerioha Dominic (Oru West LGA), Philip Ejiogu (Owerri North LGA), Micheal Onyemaechi (Ihitte Uboma LGA) and Kennedy Ibe (Obowo LGA).
Meanwhile, dem comot Arthur Egwim as Chief Whip of di Assembly join while Obinna Okwara, member representing Nkwerre replace am.
All oda standing committees for di House don dey dissolved, local reports bin tok.
BBC never fit confam weda say na thugs shoot or di aide to di lawmakers to maintain decorum afta di announcement of di suspension.
E no reach for suspension - Imo PDP react
Di Peoples Democratic Party for Imo State release statement wia dem condemn di "undemocratic suspension of Imo lawmakers".
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem also accuse di state govnor Hope Uzodinma say im dey chook mouth inside legislature mata, and say e dey "directly and indirectly sponsor actions wey fit spoil peace for di state," di statement bin reveal.
PDP, wey bi main opposition party for di state say wetin di lawmakers dey do na di work of di pipo and dat one no reach for di House of Representative leadership to suspend dem.
Oga Uzodinma and di state goment never respond or react to di whole palava wey happen today.













