Ahmed Gulak: Gunmen kill APC chieftain for Imo State

Ahmed Gulak

Wia dis foto come from, Other

Gunmen for Imo State inside south-east Nigeria don assassinate Barrister Ahmed Gulak, wey be former political adviser to former Nigerian President Goodluck Jonathan.

Di Imo State Police Command don confirm to BBC say dem don receive information of im death, and police spokesman Bala Elkana tok say dem dey investigate.

Oga Bala for statement say early on Sunday morning, "bandits block Ahmed Gulak around Umueze Obiangwu for Ngor-Okpala Local Government Area" come shoot am dead wen im dey on im way to Owerri airport to catch flight to Abuja.

Di police also add say Gulak bin no dey wit any security detail at di time and im cab driver take "irregular route to di airport".

Commissioner of Police for Imo State, Abutu Yaro, don open investigation into di circumstances of di lawyer death.

Before im death, Gulak bin be di Speaker of di Adamawa State House of Assembly. Im also be di chairman of di APC committee wey conduct di primaries for Imo governorship election.

Lately, di matter of insecurity for south-east don increase as jaguda pipo don destroy and burn state and federal properties for di region.

Di death of Gulak dey come on a day pipo for di south-east dey celebrate Biafra Day, wey be di day Lt Colonel, Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu announce di separation of Biafra from Nigeria for May 30, 1967.

Ahmed Gulak biography

Di late Ahmed Gulak na staunch politician from Adamawa state, North eastern Nigeria.

Gulak rise for politics start wen im become Speaker of di Adamawa state House of Assembly.

Im later become di Special adviser on Political matters to former President Goodluck Jonathan - di den president sack Gulak from office on April 29. Out of anger, Gulak resign im position as national coordinator of di Goodluck Support Group.

For January 2016 Ahmed Gulak pronounce himself di substantive chairman of di Peoples Democratic Party, PDP.

Before di 2019 general election, im join di All Progressives Congress (APC) from di People's Democratic Party (PDP) wia im bin serve as chairmo.

APC later select Ahmed Gulak as chairman of di APC govnorship primaries committee for Imo state.