Ibrahim Attahiru: Nigeria military confirm death of Chief of Army Staff

Wia dis foto come from, AFP
Nigeria Chief of Army Staff Lieutenant General Ibrahim Attahiru and 10 odas don die for military plane crash for Kaduna.
Tok tok pesin for Nigerian Army Brigadier General Yerima Mohammed na im confam di tori to BBC.
According to Brigadier General Yerima, di Chief of Army Staff and di 10 oda officers wey dey part of im entourage bin dey on official trip from Abuja to Kaduna.
Di Air Force bin tok for statement say di plane crash near di Kaduna airport and dem dey investigate di the immediate cause of di crash.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di crash dey come three months after one air force passenger plane crash just outside Abuja airport sake of engine failure.
Who be Attahiru Ibrahim?
Im bin replace Lieutenant Major General Tukur Buratai Rtd as Chief of Army Staff for January 2021.
Lieutenant General Attahiru Ibrahim bin dey work as di General Officer Commanding 82 Division, Nigerian Army before im appointment as Chief of Army Staff.
For May 2017, dem appoint am to lead offensive attack against Boko Haram for di North-East part of Niger.
End of Di one wey oda users dey read well well
But former Chief of Army Staff, Lieutenant General Tukur Buratai bin redeploy am afta plenti attacks by di insurgents afta dem bin give am 40 days deadline to catch Boko Haram Leader Abubakar Shekau either dead or alive.














