Nigerian Army Chief: Ibrahim Attahiru, Lucky Irabor, Ishiaka Amao, AZ Gambo first meeting wit President Buhari

Wia dis foto come from, State House
Rear Admiral AZ Gambo, Air-Vice Marshal IO Amao, Maj-Gen. I Attahiru and LEO Irabor, di Nigerian new Service Chiefs hold dia first meeting with President Muhammadu Buhari for Abuja today wia e charge dem to be patriotic, and serve di kontri well.
"We dey in a state of emergency" so make una be patriotic, serve di kontri well, as your loyalty na to di Kontri."
Di President congratulate di Service Chiefs on heading di various services, adding say;
"Nothing dey wey I fit tell you about di service, because you dey inside am. I bin also dey inside and I will pray for you. I also assure you say whatever I fit do as Commander-in-Chief I go do am, so dat di pipo go appreciate your efforts."
Major-General Lucky E.O Irabor, Chief of Defence Staff, Major-General Ibrahim Attahiru, Chief of Army Staff and President Buhari Chief of State, Professor Gambari follow attend di meeting on Wednesday afternoon.

Wia dis foto come from, State House
"You know di stage we bin dey in 2015, you know di stage we dey now, and di undertakings we make. We promised to secure di country, revive di economy, and fight corruption. None don dey easy, but we don certainly make progress." Buhari charge Nigerian new Service Chiefs
President Buhari also charge di Service Chiefs to be concerned about di morale of their officers and men, say make dem make dem feel physically and professionally secure.
Di Nigerian leader also promise say government go do dia best in terms of equipment and logistics.
End of Di one wey oda users dey read well well
BBC Pidgin find out say President Buhari decorate Rear Admiral Awwal Zubairu Gambo, Nigeria new Chief of Naval Staff; Major-General Leo Irabor, Chief of Defence Staff; Major-General I. Attahiru, Chief of Army Staff and Air-Vice Marshal I.O Amao, Chief of Air Staff with new ranks as dem meet for State House today.
Di newly appointed Service Chiefs go now control di Nigerian Armed Forces.

Wia dis foto come from, State House
Tori be say Buhari on Tuesday accept di immediate resignation of di Service Chiefs and approve dia retirement from service.
Major-General L.E.O Irabor, go replace General Abayomi Olonisakin wey don serve as Chief of Defence Staff since July 2015.
Rear Admiral A.Z Gambo, go replace Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas wey don serve as Chief of Naval Staff since July 2015.
Air-Vice Marshal I.O Amao, go replace Air Marshal Sadique Abubakar wey don serve as Chief of Air Staff since July 2015.
Major-General I. Attahiru, go replace Lieutenant General Tukur Yusuf Buratai wey don serve as Chief of Army Staff since July 2015.














