Buhari appoints new service chiefs: President Muhammadu Buhari appoint Irabor, Attahiru, Gambo, Alao as Nigeria new service chiefs

Wia dis foto come from, State House
President Muhammadu Buhari don appoint new Service Chiefs wey be di heads of Nigeria military defence.
Di new service chiefs wey go now control di Nigerian Armed Forces na:
Major-General Lucky E.O Irabor, Chief of Defence Staff
Major-General Ibrahim Attahiru, Chief of Army Staff
Rear Admiral Awwal Zubairu Gambo, Chief of Naval Staff
Air-Vice Marshal Ishiaka Oladayo Amao, Chief of Air Staff.
Presido Buhari congratulate di outgoing Service Chiefs on efforts to bring enduring peace to di kontri.
Tori be say Buhari on Tuesday accept di immediate resignation of di Service Chiefs and approve dia retirement from service.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, State House
Major-General L.E.O Irabor, go replace General Abayomi Olonisakin wey don serve as Chief of Defence Staff since July 2015.
Rear Admiral A.Z Gambo, go replace Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas wey don serve as Chief of Naval Staff since July 2015.
Air-Vice Marshal I.O Amao, go replace Air Marshal Sadique Abubakar wey don serve as Chief of Air Staff since July 2015.
Major-General I. Attahiru, go replace Lieutenant General Tukur Yusuf Buratai wey don serve as Chief of Army Staff since July 2015.

Wia dis foto come from, State House
Na on 13 July, 2015 (four years and six months ago) na im Buhari bin appoint all di service chiefs wey resign today.
Sake of tension and security concerns wey dey di west African kontri for some time now, intrest groups don dey mount presure on President Buhari to sack dem tey tey.
Dis new Service Chiefs get hard task ahead to keep Nigeria safe, secure and united.







![Orlu Crisis: Imo Eastern Security Network [ESN] clash wit soldiers, Uzodinma impose curfew](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/16E3C/production/_116665739_orlucrisisimoeasternsecuritynetwork-esnclashwitsoldiersuzodinmaimposecurfew.png.webp)








