Ada Jesus dead: 'Mmesoma Mercy Obi die for kidney sickness, her death no dey spiritual'

Ada Jesus dead: Mmesoma Mercy Obi no die of spiritual causes

Wia dis foto come from, MERCY CYNTHIA OBI/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Ada Jesus bin dey in her early 20s

Death of Ada Jesus di comedian wey real name be Mmesoma Mercy Obi no be spiritual mata but na case of long time medical care failure.

Harrison Gwamnishu wey be Ada Jesus care giver na im clear di mata on Thursday morning afta her death send shock waves to Nigerians.

At di point dem pick di comedian, her health don deteriorate as she no fit tok, di man wey bin dey organize support for her, e reveal.

"Di death of Ada Jesus no get link with anything spiritual matter", Gwamnishu tell BBC say di comedian die natural death.

Di sickness wey kill di young mother na normal thing wey dey happen to pipo, he add.

Im also reveal say Ada for no die if to say dem carry am go Hospital on time but the sickness don chop her body well well - even doctors confam am.

According to Gwamnishu, Ada Jesus bin don dey stabilise as dem carry am come the Kidney Centre for Abuja.

"Plenty pipo don even offer to donate dia kidney to ensure say Ada die but I shock as she eventually die yesterday.

"We don dey already tok to Fortis Hospital for Mumbai and Ada dey on dialysis two times every week.

"We just dey wait make she just dey okay small before we carry her commot for Nigeria for her transplant.

"Pipo dey even beg to donate money just to see say dem support her but all dat one don go as she don die.

As I dey tok to you now dem don dey move her body go Owerri. Her family go decide how dem go bury her.

"I just wan beg everybody say even as Ada Jesus don die we still need to support di family.

"Ada get one pikin and di pikin go need help as im mama don die."

"Ada suffer, beg for forgiveness, dem condemn and humiliate her". But e and im team step in wen dey see say all she need na medical care. He add.

He say dem no fit share her medical history for di past two years.

Ada Jesus dead: Mmesoma Mercy Obi no die of spiritual causes

Wia dis foto come from, Ada Jesus

Wetin we call dis foto, Ada Jesus die on 21 April for one hospital inside Abuja.

Di care giver also clear pipo wey dey blame am say why im no raise fund for her for social media and also dey blame her say why im no come social media beg pipo for money to help her health challenge.

He say Ada Jesus bin dey treated for di best Kidney hospital for Abuja, Nigeria capital before her death.

E add join say money no be di problem as one oga Engr Marksman Chinedu Ijiomah bin dey ready to drop 10 million naira to make sure say she get correct health care.

Oga Harrison explain say dem dey in touch wit Fortis hospital for Mumbai and she dey on dialysis two times weekly and dey wait make she stabilize before dem fly her for transplant before her death.

He end di statement wit "No man can take di place of God."

BBC Pidgin fit confam say dem don put Ada Jesus dead bodi for mortuary as at Thursday 22 April, 2021, a day after dem announce her death.

Ada Jesus die on Wednesday morning

"On Tuesday (20 April, 2020), we dey wit Ada Jesus till about 5 to 6pm, wen we dey go she no wan make we leave her comot , she cry say make we no leave.

Around 11pm na im di husband, Kinsley call us for phone say dem wan give her injection. because dem dey give her drugs and injection every evening"

Oga Harrison add say "E tell us di injection na 50,000 naira make I send money come, but I never send dem money direct like dat before.

We deposit directly to di hospital account to treat di girl.

But when he tok am, I come send am di money about 11pm for night.

After 10 minutes. Kingsley call me say im no know wetin dey happun again o, say Ada no fit tok again

Say she dey breathe faster, say doctors and nurses full for di ward.

I leave wia I dey , come rush down go di hospital.

True-true I see doctors dey press her chest and put oxygen for her face, Na later dem carry am go ICU

Around 7-8am in di morning, Doctor come tell us say she don die."

Ada Jesus

Nigerians don dey express sorrow over di death of di popular young comedian Ada Jesus.

23-year-old Ada Jesus, bin dey known for her skits on social media, mostly in Igbo language - although she bin dey also perform as a stand-up comedian.

She bin just celebrate her birthday only two days before di announcement of her death on Wednesday.

Di comedian, wey bin get kidney disease in February, and tori be say dem rush her to hospital after suffering a cardiac arrest - wey lead to her death.