Earth Day 2021: Step-by-step simple things to do to 'Restore Our World'

Landscape

Earth Day don land again and di organisers dey look for new ways to protect di earth.

Dis year di theme na "Restore Our World" and volunteers plus including organizers dem dey hold events all ova di world to teach pipo di need on how to take restore di earth.

Dis events include Youth Climate Summit, "Teach for di Planet: Global Education Summit" and "We Shall Breathe" virtual summit wey di Hip Hop Caucus dey organize.

Earth Day: Wetin you fit do to 'Restore Our World'

Wia dis foto come from, Other

So far dis na ten tips on how you fit help with di movement:

Reduce wetin you dey troway

Oyibo call am say na reduce, reuse recycle. Na basically wetin don popular sotay, e don turn meme.

If di nylon, neva tear finish, use am again and so on. Wetin dat one go do na to reduce di amount of waste wey dey troway, we go last las enta water.

Shey you sabi say all di plastics wey dey our ocean, dey come back to us as fish?

Volunteer to clean your area

If dem be any public day off to take clean your environment, you fit gada some pipo dem arrange to clean your environment.

E fit b fun exercise and give you responsibility to keep your area on top say you don cari hand clean am before.

Teach odas

If you know, show odas, no be one pesin go help restore di earth, influence pipo around you make dme follow do di work.

Dis dey mostly important because di earth dey on deadline, if di heat for world hot pass 2° Centigrade of how e hot now, three billion pipo go suffer from heat strokes and about ten percent of livestock dem go die.

Try to dey reduce di water, you dey use

Dis na for two reason, currently on top climate change mata, droughts don start to become more common around di world.

Also, if you manage di water wey you dey use, e go reduce di waste water wey go find way enta back our oceans.

Dey buy wetin no go to harm di world

Weda na for food, you fit consider di long term effect of di kain fish and meat you dey buy and how e fit affect di ecosystem of di world.

You fit find all di informate you need online.

Shop for tins wey be say you know go last wella

If you wan buy bag to take carry your load from market, try buy di ones yu go fit use multiple times. Again na to reduce di amount of doti for di earth.

Di same tin go for clothes. Okrika no bad tin for dis time because e mean say you dey reuse clothes wey go reduce waste.

However dat one fit hard dis days, on top di trend for fast fashion wey be cheap, trendy clothes wey dey scata sharparly.

Use long lasting light bulbs to reduce greenhouse gas

Greenhouse gas emissions mean say wen di gas wey dey ingest or digest infrared radiation alias heat wave come vomit am give di world again.

Examples of greenhouse gases include carbon dioxide, methane, and water vapour.

Pesin wey dey plant trees

Wia dis foto come from, Getty Images

Plant trees

E dey important to plant trees pass di popular reason say e dey produce oxygen wey dey important for human breathing.

e also dey help against tins like erosion and also reduce all di bad bad tins ey flooding dey do wen e happun.

E also fit create house dem for wild life like some birds and mammals.

If you must use chemicals for house, choose di one wey no dey toxic.

Dis na on top say dme no dey harm di environment and also no dey let you sick.

If you use toxic chemicals dem take clean your house, wetin go happun be say, e fit enta di water wey we dey use an you fit drink am or use am cook, without say you sabi.

No be every place you go drive, if you fit get bicycle, use am.

E get cities wey di whole place don red on top car pollution and dis mata don create serious health wahala for both animals plus including human beings dem.

Wetin you wan do na if e dey possible instead of to dey cari car everywia, you fit use bicycle take move.

Howeva, if dat one no dey possible, public transport na anoda way cos e it reduce di amount of motor for road.