World Environment Day: 'I don totally ban plastic bags for my house'

Doyinsola Ogunye
Wetin we call dis foto, Doyinsola na young lady wey dey champion beta environment mata for Lagos
Read am in 2 mins

Dis young lady for Lagos, na one of di few pipo for Nigeria wey don join some odas abroad wey no wan carri eye see pipo dey use plastic anyhow for di environment.

Since 1971 United Nations set June 5 evri year as day to tok about wetin dey happen for di environment.

"I don totally ban plastic bags for my house.' I dey reject plastic bags for supermarkets when I dey go do shopping."

"I go-go around with one water bottle so I fit avoid to dey buyi bottle water. I use bamboo pegs and wooden or metal hangers at home. And I dey recycle; use plastic again and again !"

Doyinsola Ogunye wey be young pesin wey dey promo safe environment for Nigeria, dey tell BBC Pidgin dis one.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

2018 campaign get hash tag wey be #BeatPlasticPollution, according to United Nations Environment programme.

Ms Ogunye tok say "Plastic no be di really problem but na how we don dey abuse am be di palava. Yes Nigeria go fit survive without plastic. We get di strength and oda options plus materials to use replace plastic."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

She also say 'to use plastic one time throway am na one big problem because Nigeria is kontril wey dey consume almost evritin. We just need to change our habits.'

Doyinsola Ogunye dey teach pikin how to protect her environment

Wia dis foto come from, Doyinsola Ogunye

Wetin we call dis foto, Plastic no be di really problem but na how we don dey abuse am be di palava.

Plastic use popular for Nigeria sotey e get different names:

  • Leather (bag)
  • Waterproof
  • Polythene
  • Plastic lubber
  • Lylon
  • Poly Bag
  • Nylon
  • rubber

Thousands alias tons of plastic materials full for gutters, rivers and oceans, 15 tons of plastics na im dey enta ocean every minute, according to reports by Ocean Conservancy.

In fact dem find out say e reach one million seabirds and 100,000 fish and oda animals inside water wey dey die every year on top plastic pollution.

Nigeria woman wey dey show plastic.

Wia dis foto come from, Doyinsola Ogunye

Wetin we call dis foto, Nigeria pipo sabi use plastic wella