StopTheSoot: Fire don cause air pollution for Port Harcourt
Soot mata, wey be black particles wey dey fly for air follow for palava wey dey worri pipo for Por-Harcourt.
Mata come worse on Saturday when pipo wey wan tif copper wire wey dey inside tyre put fire for tyre wey goment pack for one corner inside Port Harcourt.
BBC tori pesin Karina Igonikon report say di fire wey start Saturday night don blow enta power injection substation for Mile 1 Park area.