World Environment day 2020: 'Coronavirus lockdown don help mother nature'

Wetin we call dis Video, Coronavirus: 'Di lockdown don help mother nature'

One ogbonge Aerial photographer Imole Tobbie Balogun wey pipo sabi as Tobbie Maguire dey always use im drone take pictures of nature and tins. He follow BBC Pidgin tok wetin e don see wit im drone since lockdown begin.

He share plenty before and afta pictures of di lockdown make you sef take use appreciate nature.

Video producer: Sarah Tiamiyu