Baba Ijesha arrested: Nollywood actor Olarenwaju James chop arrest for alleged rape

Nollywood actor Baba Ijesha arrested for rape don allegedly confess to di charge, according to Police for Lagos, Nigeria.

Di popular actor wey real name na Olarenwaju James chop arrest sake of accuse say e allegedly defile 14 years old girl.

Police PRO, Muyiwa Adejobi tok for statement say CCTV allegedly capture di 48 years actor as e dey carri out di act for di house of victim.

Police say di actor don dey allegedly defile di girl since di age of seven, from wetin dem find out. and dem don begin do dia own investigate.

Di actor wey don act major nollywood movies for Nigeria dey very popular for southwest [Yoruba speaking part] of di kontri.

If court find am guilty, Olarenwaju James AKA Baba Ijesha, him risk life imprisonment as Nigeria dey tighten penalty for rape and violation of child rights.

Yomi Fabiyi call for calm

Actor Yomi Fabiyi wey say im be friend of di accused tell Nigerians to calm down as di courts never find Baba Ijesha guilty yet.

For one interview wit Goldmyne TV, Fabiyi tok say di accused tell am say im "no even get lawyer as no artistes don even visit am".

Im argue say "im no wan see pipo condemn anybody until im don get di opportunity of fair hearing".

Wetin Nigeria laws tok about rape

According to Nigeria Penal Code: Section 282 of di PC defines rape as "wen man get sexual intercourse wit a woman against her will, without her consent.

"Or when her approval alias consent dey obtained wen she dey in fear of death or of hurt".

Di section add say "sex wit a girl under 14 years of age or a girl wey no get sound mind na rape, whether or not consent dey".

Under di various Nigerian laws wit provisions on rape, di penalty for rape na life imprisonment.

However, dis no be compulsory sentence in all di laws.

E mean say di court fit decide to give a shorter sentence to di accused pesin.

Tori of rape and defilement don dey become sometin to worri about in recent times for Nigeria as plenti popular and unpopular pipo don dey fall into di crime.