AKA fiancé: Wetin we know about Nelli Tembe, how she take die and how dia relationship take start

Kiernan and Anele

Wia dis foto come from, Instagram/@akaworldwide

Read am in 2 mins

South African rapper, AKA don lose im fiance Anele 'Nelli' Tembe, ova one month afta dem bin engage.

Na di two families of AKA and im babe comot with statement to confam di death.

According to di statement, Nellie bin die for Sunday early mor-mor but dem no tok wetin kill am. She bin die at di age of 22.

Di South African police don announce say dem don start investigate into wetin kill di 22 year old woman.

About AKA wey im name na Kiernan Forbes, di statement say im dey "currently inconsolable and dey with im closest friend and family."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Though e neva clear wetin kill Nelli, tori be say she and AKA been dey for one hotel for Capetown.

Di couple Anele Tembe and Kiernan "AKA" bin share pictures of dia engagement for 21 Februuary, 2021.

Timeline for dia relationship so far

Nelli Tembe

Wia dis foto come from, Twitter/@akaworldwide

Wetin we call dis foto, Dis na photo wey AKA take introduce Nelli as im babe

Tori be say na for January rumour start to spread on top AKA and Nelli relationship afta im break up with, South African DJ Zhinle , afta video show dem dey kiss for January 2020.

For Valentine Day, im tok for social media say im dey celebrate with "new bae" but no tok who e be until March wen AKA reveal say im babe na 21 years old.

For May, im release song, Cross My Heart wey im use hail im girlfriend wey im make Twitter official dat month.

Di 33 years old enta tik-tok and bin show di inside life of di couple as dem play couple game for app wey reveal say Kiernan na di most romantic, while Nellie na di most patient.

AKA and Nelli dey kiss

Wia dis foto come from, Twitter/@akaworldwide

Wetin we call dis foto, AKA and Nelli bin reveal say dem dey date with kissing video

Tori be say di two first collabo for di first time to write song for im song, Finessin'.

And for February 2021, AKA comot to yab pipo wey tok say im no fit marry as im announce im engagement to Nelli Tembe.

Di last time wey pipo see dem on social media na as she bin dey party for event wey AKA bin dey perform.