Prophet Shepherd Bushiri daughter: Death of Israella, Prophet Bushiri child - Four tins to sabi

Wia dis foto come from, Prophet Shepherd Bushiri/Facebook
Di families of Prophet Shepherd Bushiri and Prophetess Mary Bushiri announce di burial of dia daughter Israella Bushiri on Tuesday.
Prophet Shepherd Bushiri daughter die for hospital inside Kenya, according to family statement.
But dem dey plan to fly di deadi body of di child to Kamuzu International Airport (KIA) dis Wednesday at 14:00 hours ahead of di burial for Ntcheu boma.
Prophet Shepherd Bushiri daughter Israella wey die on Monday morning 29th of March 2021 go dey buried on Thursday 1 April.

Wia dis foto come from, Prophet Shepherd Bushiri/Facebook
Pipo from different parts of di world join popular flamboyant Malawi pastor and leader of Enlightenment Christian Gathering (ECG), Shepherd Bushiri, to mourn in eight years old daughter Israella.
But wetin and wetin you sabi about di late Israella?
Four tins to sabi about "Prophet Bushiri daughter death"
1. Israella bin dey sick
Although di family no tok which kain sickness kill Israella, di sickness make her parents cari her go Kenya for treatment but airport authorities no allow her enta so she no get medical attention on time.
Inside video wey Shepherd Bushiri do to celebrate im daughter life, im say;
End of Di one wey oda users dey read well well
"E dey unfortunate say our pikin, wen she bin wan go get medical attention for Kenya, dem block her for airport and she bin no fit get access to medical attention."

Wia dis foto come from, Prophet Shepherd Bushiri/Facebook
For February, Malawi authorities prevent one private jet wey dey carry Bushiri children Raphaela and Israella, cousin Esther and mother-in-law Magdalena Zgambo from leaving for Kenya for di Kamuzu International Airport for Lilongwe.
Im add say; "E sad to hear doctors' report say if to say she bin go earlier, she for no die. She become victim of all di prosecution wey we don dey suffer for di hand of South Africa."
2. 'Saint' Israella
Prophet Bushiri bin describe in pikin as "walking angel" and "saint."
According to am, any pesin wey bin sabi Israella go testify say she get "certain special aura wey dey ooze divinity."
During worship service to celebrate her life, im tell im church members to lift up dia hands "we just want to worship di lord becos of di life of a saint, di life of a prophetess Israella."

Wia dis foto come from, Prophet Shepherd Bushiri/Facebook
3. Prophet Shepherd Bushiri daughter lead children ministry
Israella before she die bin be di leader of di children ministry.
And as di papa describe her, "she dey brilliant for her speech and get divine excellence.
Di church members describe her as prophetess.
4. Three days mourning for Prophet Shepherd Bushiri daughter
Di ECG church declare three days of mourning Israella wey dem regard as prophetess and saint.






![[Herdsmen crisis in Nigeria]: "Goodluck Jonathan home state issue Fulani cattle breeders 14 days quit notice to vacate Bayelsa?"](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/59BF/production/_117757922_-herdsmencrisisinnigeriagoodluckjonathanhomestateissuefulanicattlebreeders14daysquitnoticetovacatebayelsa.jpg.webp)









