Herdsmen crisis in Nigeria: Goodluck Jonathan home state of Bayelsa give Fulani cattle breeders 14 days quit notice?

[Herdsmen crisis in Nigeria]: "Goodluck Jonathan home state issue Fulani cattle breeders 14 days quit notice to vacate Bayelsa?"

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Cattle herder with im white herds of cattle

Di goment for former president Goodluck Jonathan home state of Bayelsa don deny say dem give Fulani cattle breeders 14 days quit notice to vacate dia land.

Commissioner for Agriculture and Natural Resources David Alagoa explain to BBC Pidgin say di Bayelsa State Livestock Management Committee bin hold meeting wit leaders of Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria MACBAN.

Oga Alagoa say na for dat meeting di state goment and MACBAN agree say make cattle herders go into only selected areas for di oil rich state.

Dis selected places na wia ranching dey permitted as a proactive step to stop any farmers and herders clash for di State.

"Di Miyetti Allah and di Livestock Committee come togeda for meeting come understand di reasons for dem not to comot for di State

But for dem to move into designated areas wia ranching dey permitted so dem no go disturb farms becos we dey go aggressively into farming."

"Plenty rice farms, cassava farms and fish farms dey wey we don collect loans for, so many farmers dey out dia. So we dey take proactive step as we no want any clash between herders and farmers as we don see happen for oda states", di commissioner add.

"So we get designated areas, for dis case, na di Bayelsa Palm plantation, so all of dem go move in dia and graze dia cattle.

Di ones wey no want do dat one go move out becos our land don dey become farmlands as we dey encourage farming and we no want situation wia herders go clash wit farmers naim make we dey separate dem." Di Bayelsa goment official tok.

David Alagoa say dem meet wit MACBAN leaders from Owerri, Port Harcourt and South East and dem too don dey encourage dia pipo to move into di designated ranching areas.

[Herdsmen crisis in Nigeria]: "Goodluck Jonathan home state issue Fulani cattle breeders 14 days quit notice to vacate Bayelsa?"

Wia dis foto come from, Getty Images

In 2018, Professor Clarence Lakpini wey be di Director of di National Animal Production Research Institute (NAPRI), don talk say Nigeria get 19.7 million cows plus 113.8 million sheep and goats.

Lakpini say di animals dey contribute 30 percent to di National Agriculture GDP and 3.2 percent to Nigeria overall GDP.

Nigeria government bin ask NAPRI make dem help to dey produce cow food as dem wan begin do cattle colonies for some states.

Dat time goment bin dey campaign to open cattle colonies across Nigeria as a means to stop di herdsmen wahala for di kontri

Dem go use di cattle colonies take provide field where di cattle go fit chop food under environment where dem go fit monitor di cows without fight.