Apam beach: Police confirm 12 children for Ghana die inside Apam beach while dem dey swim

Drown

Wia dis foto come from, Adom News

Police for Ghana don confam recovery of 12 unidentified children after dem drown while dem, dey swim inside Apam beach located, Central Region on Monday, 8 March.

De Central regional Police service for Ghana in a statement tok say dem "retrieve 12 dead bodies of pikins wey dem rescue two odas alive" for Apam beach.

According to statement wey DSP Irene Oppong wey dey in charge for Public Affairs for de Ghana Police Service for Cape Coast tok say dem get formal complaint from one Kwame Akono as at 8:40pm say "at about 5:30pm, en nephew Joshua Annor aged 15years go dey play ball for beach wey e drown with oda pikins".

According to de statement, de police tok say dem rush go de scene with search party.

"Luckily, we don rescue Simon Dadzie aged 15years and Godfred Appretsie wey get 14years, alive wey dem dey admission for de Luke Catholic hospital".

De statement further tok say dem retrieve twelve dead bodies wey dey ages 14 to 17years on Monday morning. Dis number get two female for inside wey dema body dey de hospital morgue pending autopsy examination.

De statement conclude say, "investigations dey go on take understand wetin happen".

So far rescue team dey search through de waters to retrieve de remaining bodies.

Community members say more people probably die sake of chaw kids go de Apam beach to swim on Sunday.

De kids use according to de community members, us unapproved routes to de area sake of de Covid-19 protocols which dey ban recreational activities, so dem use some area go swim wey de accident happen.

Sake of de nature of where dem use, people no find dem easily until Monday morning where dem start dey retrieve de bodies.

Oda unconfirmed reports dey suggest say de pikins be more than 20 wey dem suspect say dem die.

Ghana impose Covid-19 restrictions on activities like beach going den stuff, e no clear how de kids escape de watch of authorities until de accident happen.