Non-Career Ambassador meaning: Buhari nominate retired Service Chiefs Buratai, Olonisakin, Ibok-Ete Ibas, Abubakar for appointment - See wetin e mean

Nigeria service chiefs

Wia dis foto come from, NTA

Read am in 2 mins

Nigeria President Muhammadu Buhari don forward di names of di immediate-past Service Chiefs give di Senate for approval as non-career Ambassadors-Designate.

Dis dey come few days afta di President accept di immediate resignation of di former Service Chiefs and approve dia retirement from service.

Di President for inside letter wey e write to President of di Senate, Ahmad Ibrahim Lawan say di nominations na in accordance wit di section 171 (1), (2) (c) & sub-section (4) of 1999 Constitution of the Federal Republic of Nigeria as amended.

Di nominees na di Chief of Defence Staff, General Abayomi Olonisakin; Chief of Army Staff, Lt-Gen. Tukur Buratai; Chief of Naval Staff, Vice Admiral Ibok Ekwe Ibas; and Chief of Air Staff, Air Marshal Sadique Abubakar.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Before dia retirement, plenty Nigerians bin dey call for dia sack sake of di rate of insecurity for di kontri

If senate approve di request, di retired service chiefs go become non-career Ambassadors-Designate.

Afta dia resignation, President Muhammadu Buhari bin appoint new Service Chiefs wey go be di heads of Nigeria military defence.

Di new service chiefs wey go now control di Nigerian Armed Forces na:

Major-General Lucky E.O Irabor, Chief of Defence Staff

Major-General Ibrahim Attahiru, Chief of Army Staff

Rear Admiral Awwal Zubairu Gambo, Chief of Naval Staff

Air-Vice Marshal Ishiaka Oladayo Amao, Chief of Air Staff.

Wetin be Non-Career Ambassador?

Ambassadors na di highest-ranking diplomats wey dey represent dia kontri interest for outside dia kontri.

Di president na im dey appoint ambassadors to act as im representative for oda kontris. Dem dey always station dem for di embassy for any kontri dem send dem go. Di ambassador work na to oversee all im kontri activities for any kontri e dey and to further strengthen foreign policy goals.

Di men and women wey dey serve as ambassadors fit be either "career" members of di Foreign Service or "non-career" political appointees.

Di career ambassadors dey trained for di work, dem go di school and don get plenty years of experience of working as diplomats.

Non-career ambassadors na political appointment. Di president fit appoint pesin as non-career ambassador maybe because of im unique talent or expertise wey e go bring come di ambassadorial post no be because e get any training as ambassador.