James Brown: Instagram delete 'James Brown' account afta gbas-gbos wit Bobrisky

Wia dis foto come from, Bobrisky/James Brown
Nigerian personality James Brown don react afta Instagram delete im account from dia platform few hours afta im clash wit Bobrisky anoda popular cross dresser.
" I dey unbreakable if you pursue me comot from Instagram I go come Youtube, if you pursue me from Youtube I go enta Twitter if you pursue me from Twitter I go enta Snapchat if you pursue from me from dia I go enta Tik-tok". na wetin Brown tok
Social media site Instagram bin delete Brown account afta e do video wey e claim say e receive call from Bobrisky wey accuse say im dey copy im content as cross dresser.
Brown allege say "Bobrisky threaten to kill am".
Im add say I just dey dress like woman for fun only for Instagram but for real life I dey dress like man so Uncle Bob no see me as threat.
Dis dey happun days afta Instagram delete one Nigeria musician and entertainer, Tunde Ednut page for di second time for dia platform wey get one million followers.
Wetin Bobrisky tok?
"I dey sorry if I fall some pipo hand tonight". na wetin im tell im 3.6 million followers for im page. Bobrisky post two messages but e no call James Brown name inside di post.
For di fist post e say "I love all of una and I always dey ready to take correction when i do wrong". E end di post wit plenty love emojis.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, bobrisky222 INSTAGRAM

Wia dis foto come from, Bobrisky
Den e post anoda one wia im say "I never report anybody Instagram page before since im join IG. Pray say make nobody accuse of wetin you no know dis dis year, dat prayer deep".
Who be James Brown?
James Brown, na Nigeria popular cross dressers wey im real name na Obialor James.
Na 2018, Brown blow for Nigeria afta im viral video wey e tok say 'Dey didn't caught me' enta internet.
Brown say im find out at di age of 12 say im get HIV and na from birth e take cath di disease.













