James Brown: Meet popular Nigeria cross dresser
Producer: Dan Ikpoyi
James Brown, wey be one of Nigeria popular cross dressers say im don dey wait for dis fame to come and as di tin don show, im go use am well.
Di cross dresser wey im real name na Obialor James blow for 2018 afta im viral video wey e tok say ‘Dey didn’t caught me’ enta internet.
James Brown dey however insist say "I no be upcoming Bobrisky"
BBC News Pidgin sidon and follow am relate on how di waka don be since den.




