Nigerian police SARS protest for Surulere take at least one life - See how e happun

Wetin we call dis Video, End Sars protest for Surulere: 'Na my driver dem shoot die for Surulere End Sars protest'

One pesin die inside di #ENDSARS protest wey happun for Surulere area of Lagos state Nigeria on Monday.

One eyewitness, Samuel Okafor wey follow BBC Pidgin tok, say di victim na im driver, im no join di protest and dem bin dey go Ilupeju before di incident happun.

Di death of di driver dey come just one day afta anoda young man, Jimoh Isiaka die during di ENDSARS protest for Ogbomoso area of Oyo state on Saturday October 10.