Cameroon Zelevet killings: Fabassou Etienne, Bitouala Ciriaque, Tchanga Chiengang, Donassou Barnabas dey go jail for 10 years

Wetin we call dis Video, Na BBC Africa Eye Investigation Zelevet killings

Cameroon military court, wit Colonel Abega Epse Eko Eko don finally sentence four soldiers weh deh kill woman and pikin dem for 10 (ten) years in prison.

De four na Fabassou Etienne, Bitouala Ciriaque, Tchanga Chiengang Jean B, Donassou Gorvo Barnabas weh court find dem guilty for killing woman and pikin dem.

Ntienche Feuroli Ghislain Landry for e part get two years in prison as e no bi only film de killing.

De five soldiers go pay FCFA 206,460 ($400)as court charges and if deh no pay, weh go spend additional 6 months for prison.

Video foto from di viral clip wia one soldier dey push woman wey get blindfold for eye

Wia dis foto come from, Other

Weti go happen now

Barrister Sylvestre Mben lawyer for Fabassou Etienne say de go appeal de case for seka say e client deny say e no bi give order make de kill.

Say de order bin bi na say make de bring de wman and pikin dem for gendarmerie and two witness for army support.

But, De oda three, Bitouala Ciriaque, Tchanga Chiengang Jean B, Donassou Gorvo Barnabas, shing say na Fabassou give dem order for kill.

But lawyer for de three odas soldiers bin tell e clients say make de remain calm whatever de case as dey go still appeal.

Lawyer tok say since de families for victims nova eva show up e mean say justice no dey nova bi for dem.

Since de komot for Zelevet, e bi difficult for know if de bi Cameroonians or Nigerians and dia families no bi even dey for testify for court.