Fundraiser Erica Nlewedim: GoFundMe for BBNaija Season 5 disqualified housemate and wetin fit make fans donate over $15,000 for her

Fundraiser Erica Nlewedim

Wia dis foto come from, Big Brother Naija

Wetin we call dis foto, Erica

One day, afta Erica of Big Brother Naija comot di house, thousands of dollars don enta as donations for am but you ever wonder wetin fit make fans comot money dash celebrities?

$15,000 and rising. Dis na di money wey fans don already donate give Big Brother Naija former Erica Ngozi Nlewedim ontop one GoFundMe page wey dem set up for am.

Fundraiser Erica Nlewedim

Wia dis foto come from, Bigbrother Naija/Africa Magic

Wetin we call dis foto, Erica Nlewedim

For some na something dis kain donation to pesin wey dem fit no sabi na normal tin, but for oda pipo no be something wey dem fit ever tink to do.

Abuja-based Psychologist Kareem Folajaiye say those wey donate money na di kind pipo wey feel say dem get relationship wit Erica (even if dem no sabi am personally) and because of dis, dem want epp her to overcome di loss of di Big Brother Naija prize money.

Dis fans get wetin we dey call "complicit bias".

Fundraiser Erica Nlewedim

Wia dis foto come from, GoFundMe

Wetin we call dis foto, According to Multichoice, di organisers of di TV show, na $100k cash prize dey for di winner. GoFundMe page for Erica Ngozi Nlewedim

According to Folajaiye, no be because Erica be potential celebrity, dis fans donate because dem go do am for regular pesin join.

Di GoFundMe page show say na $100,000 be dia target.

Wen BBC ask if dis fans wey donate dey normal, or need 'epp', Folajaiye laugh say for some of di fans dem fit get "psychological issue".

As at di time we write di tori, na just 193 donate di $15,793 (N6,107,000). Dis money, according to how UN take estimate am, fit feed 7,896 Nigerians (as per $2 per day rule).

Fundraiser Erica Nlewedim tori

Wia dis foto come from, Twitter/Kareem Folajaiye

Wetin we call dis foto, Kareem Folajaiye

Dis kain donation don happun before for faraway America.

Wen Forbes comot rank say na $100m businesswoman Kylie Jenner need to become billionaire, some fans setup GoFunMe to add ontop di $900m wey di celebrity get.