You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
BBC Pidgin Edo Governorship Election Debate: Osagie Ize-Iyamu, Godwin Obaseki, Jones Osagiobare lock horns ahead of 19 September Edo vote
By 9pm Friday 4 September, 2020, three candidates wey dey eye di number one position for Edo State jam face to face ontop BBC News Pidgin Governorship Debate to argue why dem wan govern di southern Nigerian state.
Di pipo of Edo State go vote on 19 September, 2020 for govnorship election wey go decide who go lead dem for anoda four years.
Govnor Godwin Obaseki of Peoples Democratic Party, Pastor Osagie Ize-Iyamu of All Progressives Congress and Jones Osagiobare of Young Progressives Party na im show for di BBC Pidgin Facebook Live Debate wey last for ova ninety minutes.
Nigeria election office - Independent National Electoral Commission, don already clear di three candidates wey appear for di debate to contest di Edo govnorship election.
Issues wey di candidates tackle during di debate
Different segments dey di debate; section wia di candidates give dia manifesto dey.
Candidates tok wetin dem go do differently if dem win.
Di host, Helen Oyibo, wey be BBC Pidgin senior journalist, also ask dem kwesions on top some problems wey dey di state and issues wey dey affect citizens.
Click here to watch di Live BBC Pidgin Edo Governorship Debate 2020 on Friday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin Osagie Ize-Iyamu, Godwin Obaseki, Jones Osagiobare tok for BBC Pidgin Edo Governorship Debate
Di govnorship candidates of Edo State election gather to tell dia pipo wetin dem go do if dem win election for di debate wey BBC pidgin organise.
Di debate happun for BBC social media platfoms on Friday where di candidates table dia plans.
Di candidate of d All Progressive Congress (APC), Osagie Ize-Iyamu, say im get plan wey im don tag 'simple' agenda.
He say di SIMPLE wey be short for -Security, infrastructure, man power training, public-private partnership, leadership by example, employment- na area wey im wan focus on if dem elect am to be di state governor.
Godwin Obaseki di current govnor and di candidate of Peoples Democratic Party (PDP) tok thru im deputy and list di tins wey dem don do for dia current goment. He add say dem go continue.
Later di organiser tell di candidate say only di govnor go fit continue wen Obasaki take excuse to comot di show. He later come back before di debate end.
For di candidate of di Young Proressive Party (YPP), Jones Osagiobare, im say im go do partnership with some America company to help mechanise agriculture for di state.
"We wan enter partnership with some America farm to do full agriculture of di state. We wan make agriculture mechanise farming. We go also tackle future unemployment," he tok.
Wen di presenter bin ask dem wetin dem go do to fight human trafficking and migration wey popular for di state, YPP and PDP candidates say dem go create more jobs.
"If job dey pipo no go leave go abroad. We go create job for our youth. We no put teachers for our school. If di house dey comfortable, pipo go dey, APC candidate Ize-Iyamu tok.
"We wan build technology village. If we need bring in China to teach our pipo, we go do am to generate revenue and make sure say our reserve dey beta. We go diversity around agriculture and technology. We go also take care of old pipo" na wetin di YPP candidate tok about how im go diversity economy.
Di candidates condemn election thugs and encourage dia supporter not to fight or tiff ballot box.
"Thugggery na part of di culture wey I meet. Di pipo wey dey cause fight no get anything to lose. If di thuggery continue, na me e go affect and we dey do anything to ensure say we stop am. I don warn my pipo say if dem attack dem, make dem go report to police, Obaseki say.