Edo election: Godwin Obaseki visit Nyesom Wike of People's Democratic Party ahead of Primary election afta Adams Oshiomhole All Progressives Congress disqualify di Govnor

    • Author, Daniel Semeniworima
    • Role, Senior Broadcast Journalist
  • Read am in 1 mins

Edo State Govnor Godwin Obaseki of APC go visit Govnor Nyesom Wike of PDP for Rivers State Goment House inside Port Harcourt on Sunday.

Di visit dey happun two days afta di ruling All Progressives Congress party, APC, for Nigeria disqualify Edo state Govnor, Godwin Obaseki from contesting di 22 June 2020 party primary on Friday.

Wetin dem discuss for dia meeting on Sunday afternoon neva dey public, but BBC Pidgin dey follow up for updates.

See fotos of di visit

I appreciate di sustained show of solidarity, support and goodwill from Edo pipo and Nigerians in di face of injustice by di All Progressives Congress screening committee. Na wetin Godnor Obaseki tok on Sunday for Twitter post.

I go make my next move known afta I complete consultations wit my supporters and meet wit President Muhamadu Buhari, im add.

APC Screening Committee for Edo State Governorship election on Friday declare say Govnor Godwin Obaseki dey unqualified to contest in di election sake of say some wuruwuru dey im education certificates and NYSC.