School Reopening: DR Congo militia rape students wey go write examination di following day

Wia dis foto come from, Getty Images
Armed militias attack one school, rape female students wey go write examinations.
Tori be say di rapped students suppose write dia exams di following day for di Democratic Republic of Congo.
Di men attack di examination centre wey house 35 final year students for Isiro town, di capital of Haut-Uélé province.
Local authorities say dem rape some female during di attack.
Di students bin go ahead to write di examinations on Monday, according to di priest wey dey di area.
Hundreds of students run afta another attack wey dey close to another examination centres, according to AFP news agency.

Wia dis foto come from, Edizon Musavuli/Human Rights Watch
About 700 students and teachers run from di attack wey happun near di border with South Sudan.
Di militia wan stop di exams, di agency bin quote one local army tok tok pesin, Dieudonne Kasereka.
End of Di one wey oda users dey read well well











