Is Chadwick Boseman African or Nigerian?: See four ways di Black Panther star inspire kids and adults inside Africa

Wia dis foto come from, Disney/Marvel Studios
Since Chadwick Aaron Boseman die at di age of 43, afta e lose colon cancer battle, im early death don leave big mark wey show say im go pass cinema screens.
'Chadwick Boseman na African?' 'Chadwick Boseman na Nigerian?' Na some of di kwesions wey dey pipo mind, 24 hours afta di US actor die on Friday, 28 August, 2020.
Wetin we sabi be say Black Panther speak isiXhosa language (South African) for di Marvel & Disney 2018 movie wey Chadwick Boseman take blow for di world as di super hero.
Di dream Wakanda land inside Black Panther feem dey share common border with north east Nigeria.
So to ansa di kwesions wey dey dey pipo mind, BBC Pidgin don put togeda four ways wey di Black Panther star inspire pikinss and adults inside Africa

Wia dis foto come from, Getty Images
Boseman death bin generate plenty messages and tributes about im legacy. Dis na some of di reasons why di pipo go remember di King of Wakanda
1. Na im be di lead character for di first superhero movie wey cast black actors

Wia dis foto come from, Getty Images
Na 2018 dem release Black Panther. Na di first film wey dem go produce wey black actor go play as di main hero.
Boseman play King T'Challa, di leader of Wakanda, di fictional kontri for Africa wi di film dey about.
End of Di one wey oda users dey read well well
Boseman fame mark milestone for industry wey many don criticize for dia lack of diversity.
For 2014, one study bin torchlight 100 of di highest earning movies of all time and e show say only only 8 of dem get non-white lead.
"You go notice now say for di industry pipo don begin wan put their money for films wey be di leading characters, di directors or di producers," na wetin Boseman bin tell tori pipo.
"I feel say tins dey change, but no be just for Black Panther, Black Panther na just di highlight," na wetin im add put.
For Boseman, Black Panther change wetin e mean to be "young, talented, and black."
2. Black Panther bin get huge impact

Wia dis foto come from, Chadwick Boseman
Black Panther become di first comic book-based film to collect nomination for best picture for Oscars.
Di film bin get six nominations, of which e win Best Soundtrack, Best Costume Design and Best Production Design.
Di film earn more than $ 1 billion globally.
Kenyan Lupita Nyong'o, wey play Nakia, say di film no only lead pipo to "experience something mythological and folkloric," but it also allows pipo to "reflect on some really deep and important message."
Him say, for example di kingdom of Wakanda, of which di film dey tok about, bin dey highly developed because "nobody bin interrupt dem or dem bin no dey attacked by colonialism."
Dem also Black Panther based on how dem showcase women.
"You go see women dey stand alongside men wey dey in power and dem make difference to di future of dia nation in very exemplary way," Nyong'o.
For 2018, writer Steven Barnes call Black Panther standout piece of di Afrofuturism genre.
"Di film bin mix di past, present and future. Spirituality, capacity to love and exercise power.

Wia dis foto come from, Getty
Boseman na son of South Carolina for USA. Even im home state for America dey honour im death on Sunday 30 August, 2020.
Gonor of South Carolina announce afta news of Boseman death say flags for Statehouse go dey lowered to half-staff from sunrise to sunset.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
3. Im deliver powerful commencement speech

Wia dis foto come from, Getty
Boseman bin graduate from school Arts of Howard University for Washington DC
For 2018 im return to im alma mater to deliver di speech for di graduation ceremony.
Di actor ginger young pipo to find one purpose, and no be just a job.
Purpose dey cross discipline. Purpose na essential element for you. Na di reason you dey dis planet at a particular time for history, "na wetin Boseman tok.
One month before di speech, Howard students bin take part for I no gree protest to demand for transparency to ontop money mata, better conditions for students and more appropriate responses for cases of sexual abuse for campus.
"Many of una go leave Howard and enter systems and institutions wit history of discrimination and marginalization ," na wetin Boseman tok.
"Di fact say say una fight wit university wey una love na sign say una fit use una education to improve di world una dey enter."
"E no matter di career path una choose: Remember, say di difficulties you go face along di way go only help to shape your purpose, "na wetin di actor add put.
"Now na your time. Di reality go shine on you today. As you dey begin your journey, carry on with pride and purpose. "
4. Leaders and fans recognize im legacy

Wia dis foto come from, Getty Images
Even wen im dey alive and afta im die, many pipo recognize how important Boseman be.
Afta im family announce im death, Senator Kamala Harris , di vice presidential candidate with Joe Biden, post one photo am for Twitter wey she snap with Boseman.
"Chadwick Boseman bin dey brilliant, kind, cultured, and humble, "na wetin Harris write. Him leave very soon but im life bin make difference
Former President Barack Obama also tok about Boseman work and di time di actor bin visit di White House to share with a group of children.
"You fit see straight up say im bin dey blessed," na wetin Obama write for Twitter. "As e be say im dey young, talented, and black; e use that strength to give di heroes children wey dem fit admire; and do all that in di midst of pain; what a way to use im years ".

Wia dis foto come from, Getty Images
For her part, host Oprah Winfrey highlight Boseman fight against cancer.
"Showing us that greatness in di middle of surgeries and chemotherapies. This na wetin dignity look like , "Winfrey write for her Twitter.
For one segment of Jimmy Fallon's show wey don go viral, several of Boseman fans express their gratitude for di role im play for their lives.
"Thank you as you make movie wit pipo wey I see like me " na wetin one of di followers tok.
"Barack Obama and Black Panther, don define my son childhood, so thank you, " na wetin one mother with her son tok.
"As a creator and entrepreneur of color, watching this movie make me realise say our we must tell our stories, " na wetin anoda young women tok.














