IPOB, DSS clash in Enugu - See wetin we sabi about di latest palava

Flag IPOB

Wia dis foto come from, STEFAN HEUNIS

Anoda clash don shele between di Indigenous People of Biafra (IPOB) and security agencies for Nigeria.

Di Department of State Service say at least two of dia officers die from di clash, according to wetin DSS Public Relations Officer, Peter Afunanya, tok for statement wey im release.

One court for Nigeria don already ban di activities of Ipob group for Nigeria but di group still dey gather to protest and do oda tins.

Ipob dey fight for independent kontri of Biafra.

Nnamdi Kanu

Wia dis foto come from, Getty Images

Na security agencies attack us

One member of di group wey follow BBC Pidgin tok, Somto Okonkwo, say dem no kill any security officer as dem no get gun.

Afunanya bin tok say pob members attack dem "unprovoked" for Enugu State, eastern part of Nigeria.

"Di service lost two personnel for wetin be unprovoked violent attack wey Ipob member start," but Okonkwo say dis na lie.

"Na so dem dey tok every time dem attack us. Dem go say we kill but na lie. How we go kill dem, we no get gun, we no get anything and how will dey say we kill. Na dem dey always shoot," Okonkwo tell BBC Pidgin.

How dis last clash start

Pipo for Emene

Wia dis foto come from, Louis Amoke

DI police spokesperson for Enugu state, Daniel Ndukwe, say 500 members of the Ipob group block roadblocks and harassed DSS personnel.

E add say di joint force of securities agencies try stop di violence wen IPOB members bin start to dey shoot.

But Okonkwo tell BBC Pidgin say di members bin dey for Emene wey dem dey pray before joint force of security agencies attack dem.

"Dey went to pray as dem dey do every Sunday. Di police come with DSS and oda pipo. E be like joint force. Dem come to di gate and start to knock with so much aggressiveness. Somebody go open di gate, as di person open dem grab di person.

Anoda person wey dey inside see as dem dey grab di man and ask dem why dem dey grab di man. Dem shoot di man. Na dis one come make pipo angry and na like dat e start.

Emma Powerful, wey be tok-tok person of di group, condemn di riot and accuse di security agencies say dem kill at least 21 of im pipo and 47 wunjure.

"Dos wey dey responsible for dis barbaric killing for Enugu today[Sunday] must pay for dia actions against IPOB for di right time. E dey laughable for DSS to claim say dem lost five personnel for di hands of unarmed and peaceful pipo. E dey clear to all say IPOB no dey carry arm. We dey warn and ask Nigerian goment and dia security operatives to stop dis atrocity," Powerful say.