Oyo Police re-arrest Sunday Shodipe, di suspect serial killer wey escape from dia hand

Photo of Sunday Shodipe wey Police release

Wia dis foto come from, Nigeria Police Force

Read am in 1 mins

Di Nigeria Police for Oyo State, Nigeria say dem don re-arrest di "notorious murder suspect" Sunday Shodipe wey escape from police custody on 11 August, 2020.

For inside statement wey Frank Mba, di national police tok-tok pesin release, na on Sunday 23 August police nab am for Bodija area of Ibadan, di Oyo State Capital.

19-year-old Shodipe na di prime suspect for many kill-kill of citizens for Akinyele Local Government Area, Moniya. Im dey face accuse say e kill at least six pipo for rituals.

Oga patapata of Police, Inspector General Mohammed Adamu, say im wan show appreciation to kontri pipo for dia support and understanding during di time dem dey find di suspect to re-arrest am.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

When tori comot say Shodipe bin don escape police custoday, many enta social media to para give police, say dem no do well at all-at all.

Di Police later announce say N500,000 ($1,295) reward dey for anyone wey get informate wey dem fit use catch Shodipe.

Authorities never comot to tok how Shodipe take escape from custody.