Confusion dey whether IPOB don sack Nnamdi Kanu

Wia dis foto come from, AFP
Di so-called 'Radio Biafra' don claim say dem don sack Mr. Nnamdi Kanu as oga for di Indigenous People of Biafra (IPOB).
BBC Pidgin no fit confirm dis tori wey di News Agency of Nigeria (NAN) dey talk.
Tori wey full everywhere na say Mr Ezenwachukwu Sampson Okwudili go be di new person wey go dey in-charge of di station, after dem sack Mr Kanu as Director.
Indigenous People of Biafra (IPOB) na group wey Nigeria government don ban sake say dem wan break some states for southern and south-eastern comot from Nigeria, to form dia own country wey dem call Biafra.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
But for Radio Biafra Twitter dem talk say Kanu na still di oga of IPOB.
BBC Pidgin don try reach Mr. Kanu lawyer, Barrister Ifeanyi Ejiofor, but im no gree pick im phone.
All dis one dey happen as Mr Kanu still get case for Federal High Court and di matter suppose come up for November 20.
NAN talk say di illegal radio station don begin operation again, even though government close am for 2016.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di station number one program after dem resume start with one lady announcer wey talk say her name na Ifeoma Okorafor.

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Na different tori wey Radio Biafra carry for dia Twitter.
Dem carry one informate wey di talk-talk person of IPOB, Comrade Emma Powerful, write for internet.
Mr. Powerful talk say e no true say anybody don sack Kanu.
''Na Department of State Security (DSS) and Ministry of Information dey behind dis rumour because dem wan test and divide di mind of our strong followers,'' Mr. Powerful talk.
''Dem choose dis time to strike and spread dis kain rumour because of di Anambra election for 18 November 2017 wey people no too send.''
Nobodi don see Mr Kanu for outside; tori be say e vanish when di Nigeria military raid im family compound for Abia state, some months back.

Wia dis foto come from, STEFAN HEUNIS
But one thing wey dey sure be say, Federal High Court for Abuja want make Kanu come court.
Federal High Court for Nigeria don tell one of di country senator; Enyinnaya Abaribe and two other people make dem explain where di IPOB leader dey.
When court bin give Kanu wey be leader of di Indigenous People of Biafra bail for April 2017, Senator Abaribe, Immanuel Shalum Okabenmabu and Tochukwu Uchendu bin stand as sureties for am.
Wetin dat one mean na say three of dem go dey responsible to bring Nnamdi Kanu come court, when time reach and that time na November 20.











