Cameroon separatists don kill five pipo dem say be ‘black legs’ in one week - See who dem be

Di four pipo wey separatists call black leg

Afiri Comfort, Treasure Keno, Peter Njakah Chuisih, Tanjoh Christopher, Pipayou Ibrahim, dis na five pipo weh separatist kill say deh bi 'black legs'-spies for goment and barrier for Southern Cameroon independence.

Since 2016, fighting di go on for Anglophone regions as some pipo wan break form dia own kontri.

Any man weh e sell for army, tok or do any tin wit army na black leg and na de tag weh separatists di use for kill kontri pipo.

See de pipo weh 'separatists don kill inside one week

Treasure Keno

Wia dis foto come from, CHRDA Centre for human right and democracy in Afri

Wetin we call dis foto, Treasure Keno

Treasure Keno

Treasure Keno komot Batibo, Momo Division for Northwest region, e bi get one pikin and na school drop-out.

Treasure bi don go prison komot, di friend army man afta e bi don friend separatist.

E bi don di live some kana life for 'waka' 'akwara'. Deh kill e for August 3 say e di friend military man and say e bi black leg.

Tanjoh Christopher

Wia dis foto come from, CHRDA Centre for human right and democracy in Afri

Wetin we call dis foto, Tanjoh Christopher

Tanjoh Christopher

Tanjoh Christopher, big broda to former Batibo Mayor- Northwest Cameroon, bin bi Bible Translator and Pastor for Apostolic Church.

E bi Aid worker with Community Initiative for Sustainable Development COMINSUD. Tanjoh bi kweshion why separatist fighters di force villagers for contribute money for them and deh tag e black leg, shoot e for leg e bleed die .

De aid worker die for August 7, one month afta 'separatist fighters bin kill community health worker for Southwest region.

Na number four aid worker, and number three for COMINSUD weh 'separatist fighters' don kill since January 2020.

Pipayou Ibrahim

Wia dis foto come from, CHRDA Centre for human right and democracy in Afri

Wetin we call dis foto, Pipayou Ibrahim

Pipayou Ibrahim

Pipayou Ibrahim 38 years old, komot for Baba 1 for Ndop, deh kill dump de die bodie inside river, for Mile 4 quarter for Bamenda Sunday August 9.

Ibrahim bin bi na Chemistry teacher for Government School Santa, den part-time teacher for bi Progressive Comprehensive High School PCHS for Bamenda. Married wit five pikin dem.

Since separatists no wan make teachers and pikin dem di go school, deh don tag teachers black legs di kill anyone weh try for go teach.

Peter Njakah Chuisih

Peter Njakah Chuisih na man for Ndop for Ngoketundjia, Northwest. Separatist fighters cut head, hands and private part.

Deh accuse say e de betray independence for Southern Cameroon. Separatist kill e for August 11 dump for road promise for kill more black legs.

Afiri Comfort

Wia dis foto come from, CHRDA Centre for human right and democracy in Afri

Wetin we call dis foto, Afiri Comfort

Afiri Comfort

Afiri comfort na 35 year old woman wit pikin dem weh 'separatists' kill for August 11. Viral video komot as deh cut de woman e head wit cutlass. De woman bi di sell store for Makanga junction. Deh rape, torture before deh kill e say bi black leg-because e go see army e boyfriend.

But no bi only separatists di kill, army shoot three civilians for Bafut for August 9.

Separatist leaders claim say no bi dia groups di commit de crimes, condemn de killings.

Governors Adolphe Lele L'Afrique for Northwest and Okalia Bilai for Southwest regions don condemn de killings and deh promise hard taimes for 'criminals weh deh di kill for de two regions.

Rights groups for Cameroon especially woman don condemn dis acts especially for woman dem.

Felix Agbor Balla Rights Lawyer say de killings na against humanitarian law and na war crimes.