Alleged racist statue: Pipo wey dey protest for London clash wit police

Dem throw smoke bombs for Trafalgar Square

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dem throw smoke bombs for Trafalgar Square

Police don clash with groups wey do I no go gree for London, wey say dem dey protect statues from those wey dey against racism.

Dem throw Police bottles for Parliament Square, even as officers use baton nack dem back.

Wetin we call dis Video, George Floyd: Black Lives Matter speech dem wey go viral

Di Metropolitan Police don already warn di groups not to protest, sake of di bad bad tins wey happun for protest last weekend, but dem no hear word.

Plenti protesters gada outside Parliament on Saturday

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Plenti protesters gada outside Parliament on Saturday

Various groups from around di kontri, including right-wing activists, say dem come London to protect symbols of British history.

Plenti plenti of dem, white men gada around di Cenotaph war memorial in Whitehall and one statue of Winston Churchill for Parliament Square.

Pipo wey dey protest face Police for Whitehall near Parliament Square

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Pipo wey dey protest face Police for Whitehall near Parliament Square

Dem clash wit police wey wear riot gear as crowds bin dey sing "England" and dem also raise dia arms point at lines of officers.

Some of di protesters manage to break metal barriers around di Cenotaph on Whitehall.

Di Black Lives Matter movement Organisers bin don tell pipo say make dem no join any anti-racism rallies wey dem plan for di weekend because fear dey say e fit turn to fight with di far-right groups.

Di leader of di far-right group Britain First, Paul Golding bin don speak before di protest. Dem convict am last month for one offence under di Terrorism Act - Im tok say we come out to "guard our monuments".

Police dey di Cenotaph for Whitehall, as protesters gada on Saturday

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Police dey di Cenotaph for Whitehall, as protesters gada on Saturday