Coronavirus in Nigeria update: Nigerian Covid-19 cases don enta early phase of flattening

Read am in 2 mins

Records from di past 48 hours dey show say di rate of coronavirus cases for Nigeria fit don dey slow down.

For di second time di kontri record anoda lowest daily number.

Di Nigeria Centre for Disease Control, NCDC announce three hundred and four new cases wey bring total confam cases to 43,841.

Di previous day (1 August, 2020) di NCDC announce 386 new cases.

According to di latest situation report from di Nigeria Centre for Disease control, NCDC, di kontri don test at least 286,091 samples wit 10 states and di kontri capital Abuja as di places wey still get very high number of cases.

So far Nigeria don discharge at least 20,087 cases and record 888 deaths.

One ogbonge health NGO, Nigeria Health Watch tok say di west African nation discharge rate increase wella wey be say di total amount of active cases don enter early phase of flattening.

For Lagos, Nigeria largest commercial city, wey get di highest number of coronavirus cases in di kontri, di authorities don decide to allow worhsip centres re-open afta dem notice say di number of positive cases don dey reduce.

Nigeria bin first record dia first case of coronavirus for Lagos in on 27 February and since then, di kontri don enta lockdown. Latest ontop di mata be say di president don extend di lockdown for di kontri by anoda one week after di last one di presidential task force on covid-19 bin put, bit expire on 29 July.

Meanwhile as Covid-19 restrictions don dey reduce, World Health Organisation for Nigeria say make pipo dey careful wia dem dey chook head.

Avoid crowd and any small place wey breeze no dey blow well, na wetin WHO advice.