MTV Music Awards 2020: Best quarantined performance, list of nominees - See oda tins wey go dey different for di popular award

Lady gaga, Drake and Ariana Grande be nominees for MTV best quarantined performance

Wia dis foto come from, InSTAGRAM

Wetin we call dis foto, Lady Gaga, Drake and Ariana Grande
Read am in 2 mins

Dis year MTV Music Awards go include award for di best quarantine performance and best music video from home.

Di two new awards na to show how coronavirus pandemic take affect di music industry.

Ogbonge artists like Ariana Grande, Justin Bieber, Drake, Lady Gaga and John Legend dey part of music stars wey dey shook eye for di award.

Gaga and Grande bin post thank you message for Instagram afta dem nominate dem for dis award nine times.

Di pandemic bin make many music stars siddon for house during di lockdown.

Di song wey Lady Gaga and John Legend do "Together At Home concert" dey for di best quarantined performance category.

Lady Gaga

Wia dis foto come from, Global Citizen

Wetin we call dis foto, Lady Gaga
Skip YouTube post, 1
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post, 1

Di best music video from home category, na song wey Grande and Bieber collabo do during lockdown "Stuck With U" and Drake Toosie Slide video wey go viral.

Di awards go also get video for good category, wey go feature songs about di Black Lives Matter movement, like HER's I Can't Breathe, Anderson .Paak's Lockdown and Lil Baby's The Bigger Picture.

'Unique music landscape'

Di CBS Network music oga Bruce Gilmer say dem happy to release di list of nominees for dis year VMA awards.

Gaga and Grande na im pipo nominate pass for 2020, and their recent collabo Rain On Me, dey nominated for seven categories.

Skip YouTube post, 2
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post, 2

Grammy winners Billie Eilish and The Weeknd receive six nominations - and e include video of di year - Dem nominte Taylor Swift five times.

Drake, Dua Lipa, J Balvin and Justin Bieber bin get four nominations each.

Musician John Legend

Wia dis foto come from, JOHN LEGEND/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, John Legend

Dem go show di MTV Video Music Awards for 30 August. You fit check di full list of nominees on the channel's website.