You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
60-Day App Challenge: Goment don extend di application date for 60-Day App Challenge wey go make young Nigerians win #10million - See how to apply
Nigeria Ministry of Youth and Sports don extend di deadline for young Nigerians to apply for di 60-Day App Development Challenge wey fit make dem win #1million naira each.
Dem don extend di submission date from July 18 to August 12.
Di registration wey start from July 8, 2020 na to allow young Nigerians wey sabi develop apps to showcase dia talent and get chance to win multi-million naira prizes plus training to further learn how to develop di applications.
Di Grand prize na #1 million naira each for 10 ogbonge app developers wey submit di best app innovation.
How you fit apply/submit your applications for di #60DayAppChallenge
- Visit www.appchallengenigeria.com to register
- Registration don start since 8 July and e go close on 12 August
- Click on di Top page wia dem write "The Challenge" to read di guidelines before you register
- For di bottom of dis page , You go see Terms of Participation
- Afta you agree wit di terms and participation, Enta di 'Register'
- You go enter your name and your email address
- Dem go send you confirmation for your email address and how you go fit submit your app
- Participants suppose don submit dia app by 12 August
- You must dey between 18 to 29 years old to join di challenge
- Applicants must be Nigerian citizen by birth
- Di app suppose be something wey dem fit use during di Covid-19 era and afta di pandemic don go
- Di evaluation committee go contact those wey dia app don win di challenge
Which kain App you fit submit?
- If your App get any possible solution to some challenges for di telecommunication industry.
- App wey fit provide solution to any challenge for di financial system.
- App wey fit solve any Agricultural problems for Nigeria.
- Any App or technology system wey you get wey fit solve di lapses for di Health care sector.
- If you get App wey fit provide solution for any area of Sports for di kontri.
- If your App fit teach how students or teachers fit connect online or e fit solve any oda Education problem.
Wetin pesin fit win
- 10 grand prizes of N1 million each for every category.
- Business development and App development training.
- Laptops
- 50 FMYSD Participation Certificates.
Why goment launch dis App Challenge?
To engage di innovative minds of young Nigerians wey sabi design mobile applications for MSMEs, SMEs and even big companies dem.
Dem wan also use am bring out di talents and skills of di youth to develop mobile based solution wey go dey useful during di time of COVID-19 and even afta COVID-19.