You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria Air Force recruitment 2020: Airforce mil ng login portal and how to apply for online screening of di force employment exercise
Di Nigerian Air Force don officially open dia 2020 registration exercise for pipo wey wan become Airmen and Airwomen as di kontri celebrate di life of im first female combat helicopter pilot Tolulope Arotile.
Ms Arotile go don start her journey wey lead her to become hero with dis kain application many years ago. Di 2020 Nigerian Air Force application open on 24 July 2020, just one dey afta dem do final laying to rest of Ms Arotile.
Di Nigerian Air Force na di branch of military defence wey dey use aeroplane, helicopter and any oda flying equipment to take protect and defend di kontri from di sky.
Di 2020 application for Basic Military Training Course (BMTC) dey open to everybody wey be Nigerian citizen by birth and e go close on 21 August 2020.
How to apply to join di Nigerian Air Force
- Interested and qualified applicants need to apply online for www.airforce.mil.ng
- Application dey free of charge
- Na only one time you fit apply; Multiple applications go disqualify you
- You must print dis documents after you don complete di online application: a. Local Government Indigeneship Form; b. Attestation Form wey Military Officer or your Local Government Chairman go sign; c. Parent/Guardian Consent Form; d. Acknowledgment Form
- Nigeria police don begin dia 2020 recruitment exercise - Dis na how you fit apply
- Kwesions about N-Power pipo dey ask - See di ansas
- Meet di housemates of Big Brother Naija lockdown Season 5
Qualifications
- Applicants need to Nigerian citizen by birth.
- Height must pass 1.66m for male and 1.63m for female
- Applicants must dey medically and physically fit
- Applicants must not get criminal conviction(s) from court of law in dia history
- Non Tradesmen/women: a. Applicants must dey between the age 18 and 22 years by 30 June 2021
- Applicants need to have at least 5 credits, including Mathematics and English, wey no pass two sittings for SSCE/NECO/GCE/NABTEB
- For Tradesmen/women: a. Applicants must dey between age 18 and 25 years, except for di pipo wey dey apply for assistant chaplains/ imams and drivers. For dem age must dey between 18 and 28 years; b. Applicants need to have lower credit for ND/NCE or any trade certificates from reputable and approved Government institutions/organisations, with minimum of 2 passes and credit for English, wey no pass two sittings for SSCE/NECO/GCE/NABTEB
- Applicants for drivers need to have minimum of two passes for SSCE/NECO/GCE/NABTEB, with credit for English and trade test certificate
- Applicants for sportsmen/women need to show evidence of dia professional experience wey go include certificates and medals
Important Informate
- Online registration start on 24 July 2020 and go end on 21 August 2020
- Recruitment interview exercise go happun from 24 September to 12 November 2020
- Di Nigerian Air Force online registration and all oda recruitment na free of charge and applicants no go pay any money throughout
- Di attestation form must come wit passport photograph and photocopy of di signee Drivers Licence or International Passport or National ID Card. Di signee go also authenticate di passport photograph of di applicant
- For more informate, check di Nigeria Air Force or call dis number between 0930am to 0530pm Monday to Friday: 09064432351, 08043440802 and 09055840142 or e-mail: [email protected]
Wetin be BTMC?
According to di informate wey dey Nigeria Air Force website, dem say Basic Military Training Course (BTMC) na short period training for Airmen and Airwomen, wey no dey pass 6 months of training.