You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigerian Police Recruitment 2020 Screening: NPF policerecruitment.gov.ng login portal dey difficult? See police contact wey you fit complain to if you apply
Wit less than a month to wen di Nigeria Police recruitment exercise go end, di police force don release update on wia applicants fit raise complaints, if dem dey face challenges or technical difficulties as dem dey apply.
Di Nigeria Police Force for dia twitter handle say applicants fit call 0810004507 or send email to [email protected] or [email protected]
Di portal to register for di recruitment into di Nigeria Police Force 2020 still dey open and Nigerians wey dey interested fit submit dia application.
Di recruitment exercise start for 14 July and e go end for 23 August.