NDDC Probe: Nigeria lawmakers fit cari Minister of Niger Delta, Akpabio go court for criminal defamation - Dis na wetin we know

Wia dis foto come from, Getty Images
Di 48-hours wey Nigeria Speaker of House of Representatives, Femi Gbajabiamila, sama di Minister of Niger Delta Affairs to present list of lawmakers wey collect NDDC contract or face law suit don end.
Now di question na weda di House go get di mind to cari di minister of Niger Delta Affairs, Godswill Akapbio go court as im threaten for im tweet.
Oshoma Liborous, na Nigeria constitution lawyer, im say e go dey very interesting to see weda di National Assembly go get mind to cari oga Akpabio go court.
Im say wetin im do "na offence wey dem commit in front of di court.
"Wen you also come before committee of di National Assembly wey be like court under oath, every statement wey you make under oath dem believe say e dey correct.
"If you make dat kain statement and you no fit prove am, den you deny am, e mean say you come lie to di court. Di court get power to send you go prison."
But e say di koko of di mata na weda National Assembly to get mind to use dia power to send Akpabio go court.
Wetin we sabi so far
Gbasgbos between Nigeria National Assembly and oga Godswill Akapbio wey be di minister of Niger Delta Affairs, just dey hot dey go, afta Akpabio tok for Public Hearing for di House of Representatives Committee on di NDDC on Tuesday 21st July, say 60% of Niger Delta Development Commission (NDDC) contract go to di National Assembly members.
End of Di one wey oda users dey read well well
Speaker of House of Representatives, Oga Femi Gbajabiamila, come give am 48-hours order to present di names of lawmakers wey benefit from di contracts as im tok.
But on Thursday, as im neva drop di names, Oga Gbajabiamila order di Clerk of di House to get lawyer wey go cari Akpabio go court for criminal defamation of character.
Di latest development na say oga Godswill Akapbio, don write letter give National Assembly, to deny say im no tok say lawmakers na sixty percent of di pipo wey collect NDDC contract.














