Coronavirus: Covid-19 test samples miss afta Jaguda pipo 'thief' vehicle for South Africa

Wia dis foto come from, Anadolu Agency
Police for South Africa dey investigate thief-thief of one lorry wey bin dey carry Covid-19 samples for di city of Port Elizabeth.
Dem bin park di lorry outside of one clinic on Monday but dem later dem find am for anoda area afta di jaguda pipo abandon am according to wetin di public broadcaster SABC report.
But di samples wey dem put inside cooler with ice block, no dey inside di lorry again.
Health authorities don draw ear give di attackers say make di public no touch di samples because di ones wey dey infected fit dey inside, according to News24 website wey bin dey quote one official from di National Health Laboratory Services for Eastern Cape province.
Health officials dey investigate di number of samples wey dem thief so as to know how many pipo go do di test again, di website add join.
South Africa don do about 2.5 million coronavirus tests.
Di kontri get di highest number of confam cases for Africa.








