Madagascar coronavirus: Di kontri health minister ask for 'help' as dia Covid-19 cases blow

Wia dis foto come from, AFP
Madagascar health ministry dey ask for helep from partner agency dem and health companies as Covid-19 cases don begin plenty.
"Di Ministry of Health torchlight say Covid-19 epidemic for Madagascar don rise well-well in di last few weeks, especially for some regions like di capital, Antananarivo," na so di Actu Orange website report.
Tori don comot say public hospitals for Madagascar don overfull and so dem go only admit patients wey dia condition serious and disease don hook.
Di island nation currently get pass 7,000 Covid-19 cases.
President Andry Rajoelina early dis month bring back lowdown in di capital afta cases begin climb.
Wetin happun to Madagascar Covid-19 melecine?

Wia dis foto come from, Government of Tanzania
Three months don pass now since President Andry Rajoelina of Madagascar declare say im get Covid-19 cure.
Di name of di cure bin dey simple - CVO or Covid-19 Organics - and im work suppose dey straightforward - to cure pesin from Coronavirus.
But now, tori don comot of how African goments don reject CVO as treatment.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nigeria National Institute of Pharmaceutical Research and Development (NIPRD) tell BBC say di drug no be cure for coronavirus. If at all, "maybe e fit reduce fever for body of animals,"
"Dis investigation reveal say di produce fit help some pipo to cough mucus comot dia throat and e also reduce fever for di body of animals we test am on," na so NIPRD oga Dr Obi Adigwe tok.

Wia dis foto come from, Johns Hopkins University
Anoda top health oga for Nigeria say CVO na "antimalaria" melecine.
Some months ago, wen President Rajoelina promise to dash (for free) CVO drink to any kontri wey want am, Nigeria, Ghana and Congo line up to collect am.
Nigeria President Muhammadu Buhari later caution say im no go endorse di drink until im sabi scientists don torchlight say e dey work.

Wia dis foto come from, @SE_Rajoelina
Even World Health Organisation bin wash hand comot di mata say make pipo dey careful.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wetin African kontris tok
Nigeria - NIPRD tell BBC say dem no see evidence to prove say Covid-Organics dey work. Although dem say because of time dem no fit really do more tests for am.
"If to say we get plenty time and resources, e possible say still fit find some kain evidence," Dr Adigwe tok.
Congo - Africa News tori pipo bin report say Congo authorities don decide to end dia "experiment" wit Covid-Organics drink.
"Unfortunately, no patient don respond to treatment", tok Professor Alexis Elira Dokekias wey dey in charge of Covid-19 cases for di kontri.

What about Madagascar?
For Madagascar, na 121 cases dey as at 21 April. But three months afta, by 21 July, cases for di island nation don rise to 7,153.
Di way cases don dey increase for di kontri dey make pipo suggest say di drink no dey cure. In fact, one report say hospitals for Madagascar don overfull.
So far, at least 12 kontris don collect CVO including Niger, Ghana, Liberia and Senegal. But since President Rajoelina declaration nobody else don come out to endorse Covid Organics 100% say na cure for coronavirus.










