Ghana coronavirus update: What go happen to Covid-19 infected students wey no fit write WAEC exams

Wia dis foto come from, AFP
Ghana Government reveal say closing down of schools sake of de fear of Covid-19 no go happen despite calls from parents.
Health Minister, Kwaku Agyemang Manu who recently recover from de disease talk journalists say closing down of schools be defeatist approach to handling de virus.
According to Mr Manu, "who wey e know when dis disease go go away from de world? We no get vaccine yet so what we go fit do?"
"Closing down schools be defeatist. E be coward person approach wey that not what we go do" he talk journalists during en visit to Kuamsi yeste.
Ghana health authorities say de only point dem go consider shutting down schools be when 14 or 15 percent of de school population get Covid-19.
Tension start dey mount among parents after news broke yesterday say some 55 people made up of students den teachers for Accra Girls' Senior High School test positive for Covid-19.
Parents start dey ask authorities say as de kids dey school, what go happen to those wey no go fit write de final exams sake of dem get Covid-19.

Wia dis foto come from, Getty Images
What go happen to students wey get Covid-19 wey no fit write WAEC?
Ghana Education Service (GES) say despite de possibility of dis challenge, dem get plan for Covid-19 infected students wey no fit write de final exams.
End of Di one wey oda users dey read well well
GES Spokesperson, Cassandra Twum Ampofo, talk BBC Pidgin say, de "students wey no go fit write de WASSCE final exams sake of Covid-19 or any other sickness which no go make dem write de exams, we go register dem for November/December exams at de expense of govment."
"Some students too go fit start while dem get Covid-19 but dem no go fit finish sake of dema condition, we dey talk plus WAEC so say dem go give dem clemency under de WAEC regulation."
Parents for Ghana intensify dema calls for govment to shut down schools sake of fears say Covid-19 dey spread.
National Council of Parent Teacher Associations (NCPTAs) say de children dey live in fear and panic sake of dema dey hear of colleagues who dey catch de virus.










