Snow in Lagos Nigeria?: City authority explain foam chemical reaction wey pipo mistake as snowdrop

Wia dis foto come from, BBC/SCREENSHOT/TWITTER VIDEO
- Author, Daniel Semeniworima
- Role, Senior Broadcast Journalist
- Read am in 2 mins
'Snowfall in Lagos Nigeria' na im pipo begin shout out of concern afta dem see unknown snow-like substance ontop roads and streets for Anthony Village area of Nigeria commercial capital.
Na so residents of di area begin post for social media to raise alarm sake of di substance wey dem claim say dey "come out of di ground and spreading".
Some residents and commuters claim say na snow in Lagos. But no be true na foam chemical reaction wey firefighters dey use suppress fire incidents.
"A Tanker bin fall overnight and our Emergency Agencies pour di foam material to prevent combustion alias fire. Nothing to dey fear for. Lagos Safety Commission & LASEMA dey on ground."
Na wetin Gawat Jubril, di Senior Special Assistant (SSA) to di Govnor of Lagos State on New Media tok to address di mata.

Wia dis foto come from, Tweeter/Gawat Jubril A. @Mr_JAGss
Dis na part of Ikorodu road wey di goment official post after dem don begin clear am.
"Lagos State Fire service bin do blanketing of di entire area of incident as a result of wetin dey leak inside alias content leakage from di container (Black oil) to prevent any secondary incident (sic)," according to statement by Director-General of Lagos State Emergency Management Agency, Olufemi Oke-Osanyintolu.
"Di reaction from di blanketing na wetin lead to di appearance of 'snow/foam' in for di area dem wia e happun."
End of Di one wey oda users dey read well well
Gboyega Akosile, Chief Press Secretary to Lagos State Governor also clear di matter for tweet wey e post to show say dis 'snow in Lagos' na fake news.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
So dis snow in Lagos news na just mistake for Aqueous Film Forming Foam (AFFF) solutions chemical wey fit also cause health hazards if wrongly managed, BBC Pidgin Daniel Semeniworima find out.
Di findings reveal say di AFFF blanket blocks oxygen supply to any product wey fit spark fire explosion alias inflammable petroleum materials. E dey suppress fuel vapour through aqueous film and e go dome produce a cooling effect as part of the fire suppressing measures.

















