Lagos goment announce ban for 'okada', bike companies, for areas in di state.

Wia dis foto come from, Lagos State
Di Lagos State Goment announce on Monday say from 1 February, 2020 dem no allow go commercial motorcycles (okada) & tricycles (keke) to work again for some local goment for di state.
Jubril Gawat, di Senior Special Assistant on New Media to Lagos state Governor Babajide Sanwo-Olu's share di video for Twitte.
According to di goment, dis na di first phase of di ban and e go affect new bike companies like Gokada and Opay.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Oga Gawat say di ban na because okada and keke no dey safe again.
As for wetin pipo go come dey use, e say Lagos state goment dey comot new buses wey go replace di okada and keke wey dem don ban.

Wia dis foto come from, Getty Images
See di 15 local goment wey e affect
- Apapa LCDA
- Apapa Iganmu LCDA
- Surulere LCDA
- Itire LCDA
- Ikate LCDA
- Coker-Aguda LCDA
- Ikeja LCDA
- Onigbongbo LCDA
- Ojodu LCDA
- Eti Osa LCDA
- Ikoyi/Obalende LCDA
- Iru LCDA
- Victoria Island LCDA
- Lagos Island LCDA








