Coronavirus update: Police authority for different states tok say di robbery attack wey pipo dey loud no be true

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Damilola Banjo
- Role, Broadcast Journalist, Pidgin Service, Lagos
- Read am in 4 mins
Pipo for social media dey tok say armed robber dey rob for dia streets. Dem even add join say dem don turn vigilante to protect dia neighbourhood from di pipo wey wan come thief.
BBC pidgin follow police tok tok pipo yarn on wetin di force dey do to ensure say pipo dey safe and dem also get peace of mind say armed robbers no go attack dem.
Since many states for Nigeria restrict movement to take stop di spread of coronavirus, social media don full for report of alleged robbery attacks, particularly for Lagos and Ogun states.
Di tok tok person for Oyo State Police Command, Fadeyi Olugbenga, tell BBC say dem don put patrol vehicles to dey waka everywhere for di state, particularly Ibadan, di capital of di southwestern state, where dem don receive complaints.
"We get our deployment all around. We get di response squad wey dey patrol wit di patrol team wey of di commissioner of police. Di tactical teams also dey ground to help di patrols ensure say nobody cause trouble for any area.
"We even get join security patrol wey we deploy for exit and entry point likewise di convoy patrol. Di convoy patrol dey move from one place to anoda during dis lockdown to secure offices and where we don hear say robbery happun"
He tok say all dis patrol team dey strategic position to respond to distress call and to dey ensure say pipo obey di restriction guidelines for di state.
Also, di tok tok person for Zone 7, Abuja, di kontri capital, Istifanus Anus Sunday, tok say different team don dey out to dey burst hideout of criminal pipo wey dey cause wahala for some part of di state.'Di attack na imaginary one'
End of Di one wey oda users dey read well well

However, di tok tok person for Ogun State Police Command, Abimbola Oyeyemi, tok say plenty of di call wey dem receive na just say pipo dey fear say thief dey come.
"Wetin dey happun na unneccesary apprehension on di part of di pipo because plenty calls wey we don receive na just panick calls. Wen police reach places wey pipo dey claim say thief dey rob, dem no meet anything.
"As we dey now, not even one-person don come report to us say thief carry dia property. Majority of di calls be false. Dem be imaginary armed robber coming to invade a particular community,"
Also di tok tok person for Lagos Command, Bala Elkana, tok say di tori say jaguda pipo dey attack some areas for di state no be true as dem don receive plenty calls and wen dem reach di area, dey see say noting dey happun na panic call because of di rumours wey dey fly upandan for social media.
Bala say dem dey respond to all di calls wey pipo dey give say jaguda pipo dey dia area, but if dem reach there ask how far, dey go say dem still dey expect dem.
Because of that, many youths don turn vigilante begin carry cutlass and burn tyre for street say dem dey guard dia area.
But the question na how you go take know which youth get pure mind?
He say dem don follow community leaders and landlords for different communities tok, to select pipo wey dey trust to do vigilante.
Fake News social media

Police tok tok pipo say most of di post for social media na unsubstantiated rumors wey dey make pipo panic.
"I dey Agege wen one person put for social media say armed robbers dey rob for di place. I con dey worry say shey anoda Agege dey apart from di one wey I dey because I dey Agege as of that time. I con begin to drive Agege, I went to Capitol road, to Pen Cinema, I pass through Alfa Nla street… Pipo dey post for social media say armed robber dey operative but I no see anything."
For social media, plenty pipo post say thief dey rob for di community.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Wen BBC tori pipo waka go di area, no bodi sabi one person wey be victim of any robbery.
BBC gather say pipo for di community begin dey fear say thief go come dia domot, na wetin make dem gather for outside dey do watch night.

Wia dis foto come from, Twitter
Oyeyemi confam give BBC say some landlord for Ogun State bin dey call am say dem dey do watch night sake of say fear of armed robber.
"I no see reason why pipo no go fit sleep for dia house, I don tok taya say make pipo no fear. I don go radio, release statement for press to tell pipo say nothing to fear for.
'Crime rate don dey low for Kano State'For Kano State, northern part of Nigeria, di tok tok person of di command, Huruna Abdullahi, tok say since goment lockdown di state sake of coronavirus, crime sef don go down.
Abdullahi tell BBC Pidgin say pipo dey stay for house and even crime rate don reduce for di state.

Wia dis foto come from, Kano Governor Chief Press Secretary/FACEBOOK
Throughout dis period, no single armed robbery incident recorded in Kano State. currently, general accessment for `kano in terms of crimes and criminalities, all criminal activities don reduce drastically," be wetin dis tok tok person tok.
All di tok tok person say dem emergency line dey open make Nigerian dey call to report any incident of crime wey dem see.
Dem also say di Inspector General of Police for di kontri don send one Deputy Inspector General of Police go different stateto ensure say everywhere for di kontri dey safe.












