Coronavirus lockdown: Govnor Babajide Sanwo-Olu don order lockdown of Lagos

Wia dis foto come from, Lagos State Governor
Lagos don order lockdown of Nigeria commercial capital for two weeks sake of coronavirus.
Govnor Babajide Sanwo-Olu give di lockdown order on Tuesday afternoon, two days afta im tell junior and mid-level workers to work from home for two weeks sake of Covid-19 pandemic.
E also order markets to close down - 'if you no dey sell food or melecine sidon for your house" Di govnor tok.
Di lockdown order go begin from Thursday 26 March, 2020 and dem go first close down di market for di first seven days of di lockdown.
Govnor Sanwon-Olu add say e no wan carri eye see any pesin do naming ceremony or social gathering for two weeks.
Dem go send army, police and oda security for di state to enforce di order.
He also ask private offices to encourage dia workers to work from house. im sadd say make pipo no travel in and out of Lagos dis period.
According to di govnor, "di sickness come from oversee so we need to end am becos dis coronavirus no dey look any pesin face."
End of Di one wey oda users dey read well well
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Lagos State civil servants from Grade Level 1-12 go sidon for dia domot - no come work for di next 14 days wit effect from Monday 23rd of March, 2020.
Dis order go affect 70 percent of public workers for Lagos wey no go work for di next two weeks afta which di govnor go review dis decision.

Wia dis foto come from, Lagos State Govnor
Only Lagos alone don record 30 out of di 46 confam Coronavirus cases inside Nigeria. Di Nigeria Centre for Disease Control say na just two pipo don recover, including di Italian wey first carri di disease enta Nigeria and one pesin wey get di virus don die.
Di public workers wey dey affected no go just sit at home doing nothing, but dem go work from home, according to Gboyega Akosile di govnor tok tok pesin.
All health practitioners, fire station and everi oda emergency sectors no follow for di directive to stay at home.
Di govnor also advise di public to avoid visiting public offices and do most of dia bizness dem through telephone and online channels.

Wia dis foto come from, Lagos State Government
Dis na in addition to di oda measures wey authorities for di largest city inside Africa don take to control di spread of di disease. Na estimated 20 million pipo dey live inside Lagos.
Nigeria - di kontri wey get di highest population for Africa don announce say dem go close di Lagos, and Abuja international airports for one month from Monday, 23 March - dis one mean say all dia international airports dey lockdown.
Lagos goment don deploy enforcement team to catch pipo wey gada for Owambe, nightclub, echetram echetram
Lagos State goment earlier ban all social gatherings wey pass 20 pipo.
Dis dey come after di Minister of Health, Osagie Ehanire announce say Lagos don get additional seven new cases of Coronavirus for di state.
For inside Lagos state goment twitter account, di goment don arrange some enforcement team wey go catch pipo wey gada to do party, owambe or go club.
Di goment advise say make pipo no too near each oda, make dem dey at least 1 meter apart.











