Coronavirus: Travellers from China test negative for Nigeria

Pesin dey check di temperature of one Chinese traveller for Tokyo, Japan

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pesin dey check di temperature of one Chinese traveller wey dey go Wuhan from Tokyo, Japan on January 31, 2020
Read am in 1 mins

Di Nigeria Centre for Disease Control tok say five travellers wey enta di kontri from China don test negative to di novel Coronavirus, Covid19.

For inside tweet, di agency say dia protocol, na to test all returning travellers wey dey come from China with symptoms of cough and difficult respiration.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Di NCDC say no confam case of Coronavirus for di kontri yet and dey advise Nigerians say make dem disregard and discourage all di rumours.

For inside anoda tweet, di agency advise any pesin wey just come from China within di last 14 days, say make dem stay indoor and no get any kain contact wit oa pipo.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Di virus bin originate late last year for China, wia e don infect more dan 66,000 pipo and kill more dan 1500 pipo.