Coronavius: Wetin di disease isolation ward look like for Nigeria

Wetin we call dis Video, Nigeria authorities don arrange Isolation ward incase of coronavirus outbreak

Authorities for Nigeria commercial hub, Lagos state don set up Isolation centre inside di state University Teaching Hospital (LUTH) to take care of any case of coronavirus infection wey land di kontri.

World Health Organisation (WHO) bin declare Coronavirus as global health emergency, dem also tok say Nigeria na kontri wey dey dia hotlist and sis don put fear for di mind of some pipo.

BBC News Pidgin go visit di Isolation ward wey dey for LUTH to see how di kontri dey prepared in case yawa gas.