Lagos goment announce ban for 'okada', bike companies, for areas in di state.

Read am in 1 mins

Di Lagos State Goment announce on Monday say from 1 February, 2020 dem no allow go commercial motorcycles (okada) & tricycles (keke) to work again for some local goment for di state.

Jubril Gawat, di Senior Special Assistant on New Media to Lagos state Governor Babajide Sanwo-Olu's share di video for Twitte.

According to di goment, dis na di first phase of di ban and e go affect new bike companies like Gokada and Opay.

Oga Gawat say di ban na because okada and keke no dey safe again.

As for wetin pipo go come dey use, e say Lagos state goment dey comot new buses wey go replace di okada and keke wey dem don ban.

See di 15 local goment wey e affect

  • Apapa LCDA
  • Apapa Iganmu LCDA
  • Surulere LCDA
  • Itire LCDA
  • Ikate LCDA
  • Coker-Aguda LCDA
  • Ikeja LCDA
  • Onigbongbo LCDA
  • Ojodu LCDA
  • Eti Osa LCDA
  • Ikoyi/Obalende LCDA
  • Iru LCDA
  • Victoria Island LCDA
  • Lagos Island LCDA