You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Taxify to Bolt: How pipo see di name change of dis e-taxi for Nigeria
Read am in 2 mins
Popular taxi-hailing app for Nigeria, Taxify on Thursday change dia name to Bolt.
Di e-taxi company wey don dey Nigeria for two years, tok say rebranding na di reason why dem dey change dia name.
Inside statement wey dem release for social media, dem say di new name Bolt dey in line wit dia new target wey be to transport pipo fast fast witout stress.
Di online taxi service also wan add more vehicles like okada for dia brand so dem comot 'Taxi' from dia name.
See how Nigerians react to di name change
Some say even dey ask di Taxi company make dem wash di new change for am. But some odas no too dey sure of di name change.