You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ihedioha: PDP members dey protest for Owerri afta court comot former Govnor
Kontri pipo for Imo State use vex enta streets of Owerri on Sunday, January 18 to do we-no-gree-waka sake of say Supreme Court comot Emeka Ihedioha as Governor of di state.
Na members of di Peoples Democratic Party wey Ihedioha belong to, dey lead di protest.
On January 14, Supreme Court bin rule say no be Ihedioha win di last year Govnorship election, say na Hope Uzodinma be di real winner.
Di party members wey no happy wit di court decision, dey para make Supreme Court torchlight di mata again.
Dem dey threaten say di protest go continue if di court no revisit di mata.
End of Di one wey oda users dey read well well