Emeka Ihedioha: INEC don declare PDP candidate winner of Imo Govnorship election

Read am in 5 mins

23:57pm (updates): Nigeria election office INEC don declare PDP candidate Emeka Ihedioha winner of Govnorship elections for Imo State, south-eastern part of di kontri.

Party Candidates Votes

PDP: Ihedioha Emeka 273,404

AA: Uche Nwosu 190,364

APGA: Ifeanyi Ararume 114,676

APC: Hope Uzodinma 96,458

YPP: Ikedi Ohakim 527

Oga Ihedioha wey be former Deputy speaker of House of Representatives, for Abuja, go lead di south-eastern state for four years, wit dis victory.

20:25pm (Updates): Rochas Okorocha name dey miss from di list of senators-elect wey di Independent National Electoral Commission (INEC) bin publish on Monday 11 March, 2019.

INEC bin declare Okorocha Okorocha wey be di Governor of Imo state for south eastern Nigeria winner o represent Imo West Senatorial District for di 23 February election.

INEC Returning Officer, Innocent Ibeabuchi bin tell BBC News Pidgin say say im dey under duress wen im declare Okorocha as di winner on 23rd February.

9:38am (Updates): No retreat, no surrender for Imo State afta party agents bin tear govnorship election result sheets for Imo State wey make dem pause, Inec don return.

8:35am (updates): How PDP and RP party agents tear govnorship result sheets for Imo State

INEC collation centre for Imo State no fit conclude dia work to announce di govnorship election result, as kasala burst inside di hall early mor-mor Monday

BBC Igbo tori pesin wey see evitin wey happun, confam say na PDP and RP party agents tear di result sheets.

Di first pesin to tear result na di PDP man for di collation centre, Uche Onyeagocha, wey tear di Ideato South local goment area result.

Oga Paschal Onwukaike wey represent RP for di collation centre, come go di table, tear all di results dem don already announce.

Na so drag-drag start inside di hall wey make dem stop, and carri Inec officials wey dey ground comot.

Our tori pesin dey confam say di result dem tear already get duplicate, so di information neva loss and dem go resume by 9am.INEC collation centre for Imo State no fit conclude dia work to announce di govnorship election result, as kasala burst inside di hall early mor-mor Monday.

March 117:10am (Updates): Party agents take tear govnorship result sheet for Imo State

Wia dem dey announce result for Imo State INEC collation centre end for katakata for early mor-mor on Monday.

As dem dey announce di result, one party agent vex stand up begin protest. Before you go say Owerri, di man don waka go di table wia di Returning Officer siddon, carri di big result sheet wey dey table, tear am into pieces.

You fit watch di whole thing hia from BBC Igbo, or you fit fast forward sharperly go around 20mins inside di video, wen kasala burst.

21:18pm (Updates) Imo State Resident Electoral Commissioner Prof. Francis Ezeonu, togeda wit relevant security pipo don begin collation of di Imo govnorship election results.

Na tight race for Uche Nwosu, Ikedi Ohakim, Ifeany iArarume, Emeka Ihedioha and Hope Uzodima wey be di five major candidates wey dey contest di election.

18: 57pm (Updates) Police parade pipo wey dem suspect ontop Election offence

Police for Imo state south-eastern Nigeria on Sunday parade pipo wey dem suspect ontop Election offence.