Rivers State Governorship Election 2019 Result: "Make INEC declare me winner" - AAC Awara

Read am in 7 mins

17:56pm (Updates):Di governorship Candidate of African Action Congress AAC Biokpomabo Awara say make Nigeria election office INEC declare am di winner of di governorship election for Rivers State.

Dis dis tok dey come one day afta Independent National Electoral Commission, INEC suspend evritin wey concern election mata inside di state wey dey for south-southern Nigeria.

Awara tell BBC News Pidgin say because from result wey dem get, im dey lead for 15 local goment areas before INEC come suspend di election say di reason wey dem give say violence dey no hold water.

Di AAC Candidate come demand say make INEC also redeploy di INEC Resident Electoral Commissioner Obo Effanga comot because im allege say di REC and oda INEC Staff and Adhoc staff dem dey biased to favour PDP.

E claim say because dem carry pipo wey be card carrying members of PDP to be Returning Officers and because say di REC no fit conduct any election successfully for Rivers State.

INEC reply Rivers AAC candidate tok say e no hold water

BBC News Pidgin ask di INEC Resident Electoral Officer for Rivers State Obo Effanga say di allegations no dey true and e no get any substance because di Commission don set up fact finding team to audit di electoral process as e dey now.

Effanga wey dey respond to all all dis accuse for Biokpomabo Awara say e better to allow di INEC audit committee from Abuja to finish dia work.

Di INEC Oga for Rivers State say dem follow due process to appoint returning officers so if pipo wey get political interest dey inside, no be dia intention because for di training and recruitment time, dem tell each pesin say dem no go fit serve as electoral officials if dem get any partisan interest.

Di Nigeria Army say di accuse wey dey fly upandan against dem say dem dey interfere wit election for Rivers State na like e fit mislead pipo.

Some bad pipo carry jaguda pipo wey wear miliary pipo uniform to go harass and intimidate dia opponent and snatch electoral materials, Colonel Sagir Musa wey be Army Division 6 tok-tok pesin for Port Harcourt yan for statement wey im give tori pipo.

Col. Sagir come insist say di Nigerian Army no get any political side and still dey maintain dia professional conduct for di 2019 general election across di kontri as di Chief of Army Staff direct dem.

E come tell foreign pipo to mind demsef no interfere for di national internal affairs especially wen dem no get credible evidence.

Na UK High Commission bin write tori say "Make dem allow INEC staff to do dia job without intimidation"

Na wetin British High Commission bin advice authorities for Rivers State, south-southern Nigeria on Sunday wia Returning Officers of di kontri election office wey be INEC neva fit begin announce dia govnorship election results from Saturday voting.

UK High Commissioner for Nigeria say dem dey concerned about di di kain tori dia observers dey report ontop di elections wey happun yesterday for Rivers State and dem dey monitor di situation closely.

14:43pm (Updates): Nigeria Army don wash hand comot from Rivers State Election

13:50pm (Updates): Protesters for Rivers State wan INEC to release govnorship election result

12: 19 pm (Updates) Protest don begin for Port Harcourt

Some civil society groups organise protest for Port Harcourt, say make INEC release di results of elections.

Chancellor for International society for social justice and human rights Dr. Omenazu Jackson wey follow tori pipo tok, say wetin dem want na peace for Rivers State.

Di protest waka start from Polo Club to GRA Junction as security pupo wey block di road no allow dem reach INEC office wia dem bin wan go.

10:16am (Updates): Pipo don begin do hands up for Port Harcourt

Road no dey again for di popular Aba Road for Port Harcourt di Rivers State capital as security pipo block from Waterlines to GRA junction.

Dis wan don cause serious traffic jam as pipo wey dey work for di area no see road pass. Pipo wey dey waka for road get to raise dia hand up before dem fit pass as security pipo no wan take chances.

Na for dis road di state headquarters of INEC dey, and on Sunday small gbege bin happun dia wen police and army drag who suppose dey incharge. Later dat same, INEC say dem don suspend all election process for di state till further notice.

Tori be say some pipo dey plan to do protest for di Rivers State capital on Monday, and dis fit be why security don block road begin do hands up.

15:59 (Updates): INEC don suspend Rivers Govnorship election

Nigeria Election office, INEC don march break ontop anitin wey concern govnorship election for Rivers State.

Di suspension na fall out of meeting wey INEC do today wia dem torchlight all di katakata wey bin happen for plenti polling units and collation centres during di 9th March elections.

INEC say dia staff no dey safe again for Rivers State.

15:37 (updates): Rivers Govnorship Election: Make dem allow INEC staff to do dia job without intimidation - UK

"Make dem allow INEC staff to do dia job without intimidation"

Na wetin British High Commission dey advice authorities for Rivers State, south-southern Nigeria wia Returning Officers of di kontri election office wey be INEC neva fit begin announce dia govnorship election results from Saturday voting.

20:19pm (Updates): "Pipo wey wear military uniforms harass INEC Returning Officers for Rivers State"

Na wetin di oga for Voter Education and Publicity of INEC inside Rivers State tell BBC News Pidgin Reporter for Port Harcourt.

Edwin Enabor say delay for di result collation dia na because say some pipo wey wear military uniform harass dia officials for some collation centres for local goment areas and dem neva now who dem really be.

But dem don send security pipo to go verify and release dem.

Shooting, stabbing kill pipo for Rivers Govnorship election gbege

17:51pm (Update):Two pesins don die for gbege wey happen for Akinima, Ahoada West Local goment inside Rivers State.

Pesin wey dey live dia, Ovie Emmanuel tell BBC Pidgin say na jaguda pipo wey stab one of dem bottle for chest im die on di spot while di second one dem shoot am for leg but im come later die for hospital.

Ahoada West na one of di local goment wey Presidential and National Assembly election bin dey inconclusive sake of violence wey make INEC reschedule supplementary election to hold dia today.

Also for Andoni local goment, jaguda pipo also don kill former caretaker chairman, Hon. Emilia Nte.

One local pesin Hannah Innocent tell BBC Pidgin say na yesterday dem kill her for di boundary between Asarama and Egendem as she dey go her village for Unyada all for Andoni local goment

16:01pm (Update): Rivers State govnor Nyesom Wike vote for im polling unit for Obio-Akpor area

Na 29 states for inside Nigeria dey vote to elect govnor and house of assembly members on Saturday.

For Rivers state wey dey south-south of di kontri, dis na di candidates wey dey conest for be govnor and dia deputies: